South Africa police say dem find bullet holes, gun cartridges and deadi bodies wen dem arrive di scene of two mass shooting.
Police say dem respond to reports of shooting for KwaZulu-Natal and Pretoria.
Read more: www.bbc.com/pidgin/articles/cq4gnl9kvl1no
BBC News Pidgin
BBC News Pidgin is an online news service in West African Pidgin English that was launched by the BBC World Service in 2017. It is based in Lagos, Nigeria. More on Wikipedia
-
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
-
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Dem don announce di new James Bond actor.
You sabi who e be?
Read more: www.bbc.com/pidgin/articles/c5n4ex1k1r34o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Comedian Russell Brand crimes bin happun between 2004 and 2009 and now e dey appear for court for sentencing.
Read full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cm1dwdg3rq9qo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Get in joooorr!!!
Nigeria Flamingos don set new record!
How you go rate di Nigeria U-17 women team?
Check highlights for hia: www.bbc.com/pidgin/articles/ckj0ll077nleo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
GOOOAAAAALLLLL ⚽⚽⚽⚽⚽
Nigeria 2 - 0 Japan (48 mins)
Nigeria don dey lead wit two goals for di Fifa U-17 Women World Cup against Japan.
Follow live updates: www.bbc.com/pidgin/articles/ckj0ll077nleo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Paul Mackenzie, di self-proclaimed pastor wey authorities find guilty say e lead one doomsday cult for Kenya wey lead to di death of more dan 400 pipo don chop 200 years prison sentence.
Read full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cwd099lr19xxo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
For im post on Monday 2 November, 2026, Ned Nwoko say make pipo leave Regina Daniels alone, make dem no drag her inside fake 'death announcement' tori wey some pipo dey spread.
Read full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cqn73nv3ydn1o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Dem shoot and kpai Thomas Frimpong 15-year-old son wen e bin dey go school on Thursday, 29 October 2026.
Read more on di tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cqwy7dr06ye7o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Nigeria govment don launch monthly cash relief programme wey go help reduce di impact of di rising cost of living.
For di relief programme, govment say dem go give each household 50,000 naira, about ($37.14) evri month.
Full tori: bbc.com/pidgin/articles/c6pvgp1gpjyvo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di papa of Ghanaian teenager Javits Frimpong don describe how dem bully im son bifor dem kpai am for di Bronx borough of New York City, United States.
Dem shoot and kpai Javits wen e bin dey go school on Thursday, 29 October.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c5vgjzr91zmjo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Independent National Electoral Commission (Inec) don explain why AI-generated images and some irregularities dey for di preliminary voters register wey dem release online.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c6gelpr1qq29o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Cryptocurrency giant Binance on Thursday say $6.3bn (£4.7bn) worth of digital assets don dey affected by di biggest crypto hack wey don eva happun in history.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cry832q3277go -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Alzheimer's Disease na di most common cause of dementia, a general term for memory loss and oda cognitive abilities serious enough to interfere wit daily life. Alzheimer's Disease dey account for 60-80% of dementia cases.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/ckz7x87yypwdo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Star Trek actor Sir Patrick Stewart don die at age 86.
Sir Stewart die for im home for Los Angeles on Wednesday afta brief battle wit Alzheimer's Disease and Lewy Body Dementia.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/ckz7x87yypwdo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Imo State chapter of di All Progressives Congress don insist say na Govnor Hope Uzodimma be dia candidate for di Imo West Senatorial District for di 2027 general elections afta court declare say na ex-govnor Rochas Okorocha.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c370pdypjk01o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
At least 68 pipo don kpai and dozens injure afta one Spanish high-speed train jam anoda train for south of di capital Madrid.
Dis na Spain worst rail disaster since 2013.
www.bbc.com/pidgin/articles/cwvgd48z416ro -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
TUC tell President Bola Tinubu to increase salaries and implement di Joint Health Sector Unions (JOHESU) agreement instead of di 70,000 naira six-month transportation allowance wey Nigeria govment approve for workers.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cwkg5e91j5glo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di 2026 Russia-Africa summit bin dey gada delegations from about 48 kontris, including 22 heads of state.
E dey happun three years afta di last summit wey happun for St Petersburg for 2023.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c95ynvx4en43o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di transport intervention na for all workers across all levels and e go last for six months and e go start for Novemeber 2026.
Read more: www.bbc.com/pidgin/articles/cwkg5e91j5glo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Authorities say di accused "dey face maximum penalties of 20 years imprisonment for conspiracy to commit mail and wire fraud, 20 years for money laundering, and 10 years for access device fraud, plus mandatory sentence of two years for identity theft."
www.bbc.com/pidgin/articles/cmq8nwv3vlqvo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
One foreign national wey attempt to carry bomb enta South Africa through Lebombo port don chop 10 years prison sentence.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cmlyd00np226o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Independent National Electoral Commission (Inec) through dia tok-tok pesin Mohammed Kudu Haruna say dem go investigate di alleged AI-generated images of voters ontop dia website.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c6d7q0j1wn15o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Nigeria govment don find out wetin kpai di 37 pipo wey bin dey for di NSCDC custody for Niger State.
Di Independent Investigative Committee wey chook eyes inside di 37 deaths find out say di alleged illegal miners die of suffocation.
Full tori: bbc.com/pidgin/articles/cxyvr917j4y0o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Dem born Gadi Eisenkot for Tiberias to working-class parents from Morocco.
If e defeat Netanyahu for di election, e go bicom di first Mizrahi prime minister for Israel history.
Read full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c5gm0l4j871wo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
England and Bayern Munich forward Harry Kane don win di 2026 Ballon d'Or award, while Alexia Putellas of Spain win di award for di women category.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cw7vpj3e65r4o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di 2026 Ballon d'Or award go happun on Monday 26 October, for di London Palladium Theatre wia dem go crown di best footballers wit individual prizes.
www.bbc.com/pidgin/articles/cw7vpj3e65r4o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di pipo of Kula community for Akuku-Toru Local Govment Area of Rivers State on Thursday 22, carry di five dead bodis wey dem recova from di boat accident wey happun for Robertkiri waterways go Govment House.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cmn06gd186l8o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Ogbonge Nigerian actor Francis Duru don die at di age of 57, im family announce on im official Instagram account.
Dis dey come one month afta di death of anoda actor Olu Jacobs.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cm4g197932g1o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Ogbonge Ghanaian actor, media personality, comedian and politician Seth Kwame Dzokoto don die.
E die on Wednesday, 22 October, afta e collapse during one live radio show.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c6g7xn4gyz29o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Chukwuemeka Akagha Dennis tell BBC say im Ebola experience make im mind strong well-well as im no dey fear anytin again.
Dennis believe say if im fit survive Ebola, im go fit survive anytin.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c6wyd5p5z224o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Police for KwaZulu-Natal Province dey investigate di circumstances around di murder of one foreign citizen, wey dem believe say dey in im his late 30s or early 40s.
Police say one group of pipo allegedly assault am to death on Thursday morning
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c6kglk8wgwxgo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
As e be now, Nigeria health authorities don start to trace di contact of about 44 pipo wey bin get contact wit dis first Ebola case wey don already dey for isolation for one hospital facility for Abuja.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c6kglk290n0po -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
One South African woman kpai afta shark attack her near di kontri east coast.
Witnesses say di shark bite di 65-year-old for two places and she die bifor dem carry her comot from di water.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c6ly3dyvjpj5o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di headmaster for di Obuasi Senior High Technical School for di Ashanti Region of Ghana don step aside afta e chop accusation wey involve alleged sexual abuse.
Read more for hia: www.bbc.com/pidgin/articles/cq4g1vw8jk3no
#ghana #obuasi #bbcnewspidgin #ashanti -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Wit just less dan three months to di 2027 general elections for Nigeria, di issue of petrol subsidy na still one of di ogbonge issues wey fit determine how di election fit go.
President Tinubu, Atiku, Obi and odas get different positions on fuel subsidy.
www.bbc.com/pidgin/articles/c3ewenn7pljlo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Na for 2025 dem send Chukwuemeka Victor Amachukwu to US from France wia dem gbab am. Im and im group bin wan obtain $8.4 million but na $2.5 million enta bifor dem detect dem.
Full tori: bbc.com/pidgin/articles/ckp8gj9n7ze2o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
For one statement, Nafdac say di agency commence investigation into di death of di corps member afta tori spread say na fake and low standard medicine cause di death of di NYSC member for Enugu camp.
Dem reveal wetin kpai di corper for camp.
Read more: www.bbc.com/pidgin/articles/cqn736ln02plo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Former Delta State govnor, Emmanuel Uduaghan, die at age 71.
Uduaghan, wey govern di south-south state from 2007 to 2015, die on Monday, 19 October, im family announce.
Read more: www.bbc.com/pidgin/articles/cq9vzdvpzd8ko -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Wen some youths for some communities for Ondo State begin kpai one afta di oda, pipo start to wonder wetin fit cause di death until dem realise say na one locally made drink.
Some of di families of di pipo wey kpai tell BBC News Pidgin wetin happun.
www.bbc.com/pidgin/articles/cm8ez1y96r0xo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Mackenzie and 29 of im followers chop accuse for di murder of 191 children.
Im cult chop accuse say dem force children to starve to death so dem go fit "meet Jesus".
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c6x2vx719rkzo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di French interior ministry don condemn wetin dem call "targeted act of violence" and dem accuse some protesters say dem dey try to loot and dem dey also attack police.
Read di full tori:www.bbc.com/pidgin/articles/cmy83gzv1y63o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di 42-year-old spend di days afta dat to defend hersef, and answer tough questions from tori pipo about her credentials and weda she ready for di job.
Full tori:
www.bbc.com/pidgin/articles/cqm24m0vryd4o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di nominees include four new national commissioners and two new resident electoral commissioners.
Di development dey come exactly three months to di 2027 general elections wey according to Inec timetable go start on 16 January.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c3x2wven77gko -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Nigeria Minister of Finance and Coordinating Minister of di Economy Taiwo Oyedele don tok about di next step for commercial drivers for di kontri afta di Nigerian National Petroleum Company (NNPC) 30 days for fuel price discount finish.
bbc.com/pidgin/articles/c6je5vwyxdx4o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Nigerian Communications Commission (NCC) don announce say dem don start one new system to check mobile phones and oda communication devices wey pipo dey use for Nigeria and say dem go block some phones wey no get registration to work for di kontri.
www.bbc.com/pidgin/articles/cjn5vyp95l3vo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Court of Appeal for Finland don reduce di six-year prison sentence wey one District Court bin sama on Simon Ekpa afta e find am guilty of terrorism and oda charges, according to information on di court website.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cm15jnxdnegqo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Family confam di death of di gospel singer inside one statement ontop im official Instagram page afta reports bin emerge on social media say Toluwanisings don die.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/ck3wvdqvqye8o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Pikin marriage dey happun wen one or di two spouses dey under di age of 18 and dey happun for social, cultural, economic, and family reasons.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cmgj986l4pp9o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Reports of Toluwanisings death begin trend afta Nigerian lawyer Pelumi Olajengbesi post dis on social media: "My God! What a life! No, Lord! We plead for Your mercy upon Toluwanisings..."
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/ck3wvdqvqye8o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Prosecutors argue say although Duane "Keffe D" Davis no fire di gun imsef, na im be di ringleader of di group wey commit di murder.
E admit for im memoir say e bin provide di gun wey dem use for di crime.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cm89zgkdqjl3o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di All Progressive Congress don set for di 2027 presidential election as dem don revise dia campaign council list.
FCT Minister Nyesom Wike, Anambra and Osun State govnors Chukwuma Soludo and Ademola Adeleke make di list
See odas wey dey: www.bbc.com/pidgin/articles/cwdd8er6935no -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di opposition New Patriotic Party don condemn di appointment of madam Emelia Afi Agbenyo to di electoral commission.
Dem say di president don appoint im political party activist to di sensitive role of deputy chairperson for di commission.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c6x2w7n88erko -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Federal High Court for Abuja don strike out di eight count criminal charge wey di federal govment bring against di alleged fake Director General of di Presidential Foreign Intervention Promotion Council (PFIPC), Adeniyi Adeyemi.
Full tori: bbc.com/pidgin/articles/cqp8gk126xz3o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Federal High Court for Abuja don strike out di eight count criminal charge wey di federal govment bring against di alleged fake Director General of di Presidential Foreign Intervention Promotion Council (PFIPC), Adeniyi Adeyemi.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cqp8gk126xz3o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Geoff Ogunlesi marry im longtime sweetheart Jennifer Meyer on Saturday for Hawaii, United State.
Geoff na di son of Nigerian billionaire lawyer and investment banker Adebayo Ogunlesi.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cm62yzp890zno -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Lagos State High Court don cancel Euracare Multi-Specialist Hospital application wey dey request to stop di coroner examination into di death of Chimamanda Adichie pikin, Nkanu Esege.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cx30emg35dp7o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Yemen Houthis don warn aviation firms and passengers make dem no use Saudi airports and airspace as dem claim responsibility for di previous attacks.
Read di full tori:www.bbc.com/pidgin/articles/c9x28gvx7zlpo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Independent National Electoral Commission (Inec) release di full list of govnorship candidates and dia political parties ahead of di 2027 general elections.
Di full list dey hia:www.bbc.com/pidgin/articles/cwdr8x0ny55ko -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Kingsley Chinda name begin trend months ago wen im emerge as di govnorship candidate for di All Progressives Congress (APC) for Rivers State wen di public bin know am as member of di Peoples Democratic Party.
List of top candidates dey inside dis tori:www.bbc.com/pidgin/articles/cwdr8x0ny55ko -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Police say di suspects go face charges of public violence and malicious damage to property, wit di possibility of oda charges.
Di suspects go showface for court soon. Read di full tori :www.bbc.com/pidgin/articles/cmp3gw6yx3vpo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di announcement on Friday na di lastest effort from Trump to lower fuel prices.
But why Trump dey make deal wit di US? E dey inside dis tori: www.bbc.com/pidgin/articles/crkg7xy73jgeo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Nidal Hasan na former US Army major and psychiatrist wey dem convict say e carry out one of di deadliest shootings for US military installation.
Di public go fit watch im execution by firing squad, US Defence Secretary Pete Hegseth don tok.
bbc.com/pidgin/articles/cqrky0k3g0zjo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di 30-day discount on petrol price wey Nigerian govment announce don cause tok-tok across di kontri.
Pipo don begin ask if subsidy don return, who fit benefit and wetin govment hope to achieve wit dis discount.
All di answers to di questions dey here: www.bbc.com/pidgin/articles/cq3981kl3mg2o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Ogbonge tragedy bin hapun for di Kuje area of Abuja, Nigeria capital, wia three children from di same family bin kpai as river carry dem away wen dem bin dey play.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cm70p8j6g5y0o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Wen Wicknell Chivayo and im wife die for helicopter crash last week, many pipo show dia love and hatred for dis wealthy Zimbabwean man.
But why dem love and hate dis man for Africa? E dey inside dis tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c95ynx202dpyo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Kenya Airways don confam say one passenger die for dia flight wey bin comot Nairobi dey go Lagos afta e become unresponsive bifor di aircraft land for Murtala Muhammed International Airport in Nigeria.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c9j34m48v7pro -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Apart from di late Cardinal George Pell wey bin chop jail sentence and den acquitted, Christopher Saunders go be di most senior Catholic leaders for di kontri wey go dey charged wit sex crimes.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/ckvg6wyw9d4po -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Vaginal agenesis na rare congenital condition wia dem born woman either witout uterus and upper vagina or say di uterus and upper vagina no develop well.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cmd7qn9dn4eno -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Any pastor wey authorities catch for Ghana wey dey preach inside public bus fit chop jail sentence, fine or both.
“Many passengers need our message of salvation to repent from dia sins. We even dey heal di sick for some buses," one pastor tok.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cm4g15vepeglo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
One resident of Aguleri community for Anambra State wey follow BBC News Pidgin tok say di kasala between di community and Umuoba Anam don trap dem for house and fears dey rise.
Na land dispute cause di kasala wey don kpai and injure pipo.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c680zrvggy3yo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Millions of pipo from all ova di world dey perform Hajj and Umrah evri year and dem dey carry Zamzam water go house.
Belief be say Zamzam water get special power as di Zamzam Well no dey dry.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cw5ynk9884gjo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Anoda batch of 105 Nigerians on Friday, 2 October return home from South Africa sake of xenophobic attacks on foreign migrants.
Dis dey come days afta di 30 September deadline wey anti-migrant groups give illegal migrants to go back to dia own kontris.
bbc.com/pidgin/articles/c84g1e7w3e46o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Ethiopia and Eritrea cut diplomatic relations as renewed fight for northern Ethiopia dey raise fears of wider regional conflict.
Why kasala burst between dis two kontris? E dey inside here: www.bbc.com/pidgin/articles/cmd949133lexo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Family, friends and fans don say bye-bye to ogbonge actor Olu Jacobs as dem bury am for Lagos on Friday, 2 October.
Jacobs kpai for September at di age of 82 afta e afta e battle dementia wit Lewy Bodies for many years.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c8x2394g3en2o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Gunmen don kidnap up to 19 pipo, most of dem prospective corps members of Nigeria National Youth Service Corps (NYSC) afta dem attack two buses for Imo State.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/crx2z2wxv8ljo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Omoyele Sowore, Atiku Abubakar, Lagos State Govnor Babajide Sanwo-Olu get different messages for Nigeria as di kontri dey celebrate 66th Independence Anniversary.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c862e27x59nzo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di social media for Nigeria don dey buzz sake of one $2.1 million court mata wey allegedly involve Jordan Wike, son of di Minister of di Federal Capital Territory, Nyesom Wike.
Full tori: bbc.com/pidgin/articles/cqvgygn1rnwro -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Popular Zimbabwe businessman Wicknell Chivayo, togeda wit im wife, Lucy Muteke, die for helicopter crash.
Chivayo get close ties to many African presidents.
Read more: www.bbc.com/pidgin/articles/c94gmg2myvjro -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Animal rights activists don criticise Botswana decision to authorise di killing of 23 elephants to provide meat for independence celebrations.
Full tori: bbc.com/pidgin/articles/ckj065lz4dppo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Hundreds of South Africans enta streets on Wednesday, 30 September to protest against gender-based violence and illegal migration.
March and March bin announce 30 September as deadline for undocumented migrants to comot from di kontri.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c35y711dykx4o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Ibrahim Traore open gold refinery for Burkina Faso.
Burkina Faso na one of di biggest gold producer but di authorities don dey struggle to regulate di informal mining sector, wey di jihadist kasala for di area don scata.
Read more: www.bbc.com/pidgin/articles/cmy5zx2z3gv9o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
One pilot for one Israel-bound plane stab im co-pilot and "apparently try to crash di plane", Israel Prime Minister Benjamin Netanyahu tok.
Na passengers save di situation and ensure say disaster no happun.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cxddv1j3l1d2o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
One pilot for one Israel-bound plane stab im co-pilot and "apparently try to crash di plane", Israel Prime Minister Benjamin Netanyahu tok.
Na passengers save di situation and ensure say disaster no happun.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cxddv1j3l1d2o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Dr Adeda allegedly kpai afta one incident for di Examination and Records Department of di Ministry of Secondary Education.
Tori be say na thugs come beat am afta e get kwanta wit di commissioner of secondary education.
Read more on di tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c50m3d1pvlmno -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
President Cyril Ramaphosa don announce four immediate measures to tackle violence against women.
Im announcement dey come afta police discova di deadi bodi of twelve women in and around Ekurhuleni, east of Johannesburg, within just two months.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cmwyz9nr1w2po -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Guinea-Bissau flog Nigeria 3-0 for dia Afcon 2027 qualifiers.
How Nigeria take chop three goals and no score anytin? E dey inside dis match highlight: www.bbc.com/pidgin/articles/c63regn8d0yvo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Gambia press Ghana neck as dem stage epic comeback from 2-0 to win 4-2 against Ghana for dia Afcon 2027 qualifiers.
See how di match take waka: www.bbc.com/pidgin/articles/c6z7z4vl0wr3o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Guinea Bissau dey sama Nigeria 1-0 for dia Afcon 2027 qualifiers.
Second half go soon start. Nigeria go fit equalise and win di match?
Follow live updates for here: www.bbc.com/pidgin/articles/c63regn8d0yvo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Gambia no wan gree for Ghana for dia Afcon 2027 qualifiers as dem play 2-2 for first half.
Second half go soon start. Wetin be your prediction?
Follow live updates for here: www.bbc.com/pidgin/articles/c6z7z4vl0wr3o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Dem don crown Edward Rukidi Kijanangoma king of Uganda Tooro Kingdom.
For long, di new monarch na familiar face for di East African nation, but many pipo no sabi am as heir to di throne.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cm86x8wn636do -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Edo State Special Criminal Court, south-south Nigeria, don sentence four kidnappers for di state to death by hanging.
Dis dey come afta Govnor Monday Okpebholo vow to sign death warrants for criminals wey dem sentence to death for di state.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cmlyq5vk9el3o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
South Africa President Cyril Ramaphosa go on Tuesday, 29 September address im kontri pipo on top steps im administration dey take to tackle gender-based violence and femicide (GBVF).
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cmwyz9nr1w2po -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Police for South Africa don discover di bodies of three more women for one area for di east of Johannesburg.
Dis don bring di total number of bodies dem find to 12 in just two months.
Here na di faces of di women as one suspect don kpai: www.bbc.com/pidgin/articles/cmlyqkqvdw52o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Suspected bandits don kidnap more dan 60 pipo for separate attacks for northern Nigeria.
Dis na di for di latest wave for di series of kidnappings wey armed criminal gangs don carry out dis year.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c60m3e7jmwxgo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Christa Pike, wey dey 50 years now, bin dey 18 wen she and her boyfriend dat time, Tadaryl Shipp, beat, torture and murder Colleen Slemmer, one 19-year-old wey dem bin meet for job training camp for teens wey dey troubled.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cx980zvgjn79o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Police say dem find di remaining parts of human bodies for inside forest for Abia State.
Police say dem suspect say di bones and skulls belong to pipo wey jaguda pipo kidnap and hide for inside forest for di two locations.
Read full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c962jy71e638o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Independent National Electoral Commission (Inec) for Nigeria go deploy artificial intelligence (AI) to take make sure say wuruwuru no go dey for di kontri general elections wey dey come up for January 2027.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cqlykxkemnldo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Nigeria go face Madagascar for di 2027 Africa Cup of Nations qualifying match wey go happun on Friday.
Di Super Eagles go host di Barea of Madagascar for di Godswill Akpabio Stadium, Uyo, south-south Nigeria.
Wetin be your prediction?
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cr624vy3lg89o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Anoda batch of 105 Nigerians don return home from South Africa, as concerns dey grow ova di safety of foreign citizens ahead of di 30 September deadline wey anti-migrant groups give illegal migrants to comot for di kontri.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cqgmrk0wz4x0o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di hackers, Shiny Hunters, tok say dem get di name, role, badge number and personal details of evri FBI agent, including dia home address, phone numbers and spouse information.
Read full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/crvgy915v5dxo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di long-awaited boxing clash don land!
Anthony Joshua and Tyson Fury go show face-to-face for one news conference for London on 30 September, as di build-up start to one of di most anticipated fights for British boxing history.
Who go win?
Read More: www.bbc.com/pidgin/articles/cky8zej7dp4vo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
US govment don announce new visa restriction policy for foreign citizens wey intentionally travel to di kontri just to born pikin, so dia pikin go be US citizen.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cm5y74085de5o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Black Stars of Ghana dey begin dia 2027 Afcon qualifiers wit ogbonge match against Ivory Coast for Thursday.
Wetin be your prediction?
www.bbc.com/pidgin/articles/ck05rq7g91jno -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Australia govment don launch sharp-sharp review afta OpenAI agent "break into" di govment healthcare scheme portal wey be Medicare.
Di company say "our models take actions wey no be our plan" - and e no see any record of patient data wey e access.
www.bbc.com/pidgin/articles/cwlykx1g23rlo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
"You want make I tell you secret? I be my husband stylist," dis na wetin Olori Atuwatse III tell BBC News Pidgin for one exclusive interview.
Olori Atuwatse III also tok about polygamy and education for Niger Delta.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cxe87mpv3ey9o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di govnors of di All Progressives Congress no gree for di Minister of di Federal Capital Territory Nyesom Wike on wetin Rainbow Coalition wan achieve.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cx1l6yg2n00lo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Ghana Black Stars coach Carlos Queiroz wey di football association bin re-appoint don defend im philosophy as im return to take ova di team for di Afcon qualifiers.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c60reygr194wo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Wife of one Ghanaian professor for di Southern Illinois University dey face murder charges for court.
Betty Akamani dey accused say she allegedly shoot her husband many times when im dey inside car afta im drop of dia two children.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cme307w0d177o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Presley Gerber, di son of supermodel Cindy Crawford, don die at di age of 27.
Gerber, wey be model, die for one rehab facility on Sunday, according to records wey di Los Angeles County Medical Examiner file.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cwly7p53knx2o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Nigeria Hydrological Services Agency don warn about high riverine flood risk across 15 states between September 19 and 25, 2026.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c6vgyzrdp71po -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Lindsay Clancy no deny say na she kill her three children, but her lawyers argue say dem no suppose hold her legally responsible bicos she dey suffer from severe mental illness.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c699dl31x809o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
For one lengthy post on Truth Social on Friday, Trump say di outlets dey "constantly write or report fiction or lies" about im administration, although e no provide examples.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cmy8z10nx119o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Presidential candidate of di African Democratic Congress (ADC) Atiku Abubakar say Nigerians dey live wit di consequences of petroleum subsidy removal wey no get adequate protection for citizens during di transition.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cje3rd1z2wg6o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di University of South Africa don condemn di xenophobic attacks wey dey happun for South Africa.
"We condemn xenophobic violence and di targeting of African migrants and foreign nationals for South Africa and evriwia for di world,” dem write.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cmj4jzrvjr59o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Nigeria Security and Civil Defence Corps (NSCDC), Niger State Command, don confam say some illegal miners wey dem arrest and put for dia custody don kpai.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cmj64dy663e5o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
One court for Abuja, Nigeria capital don sentence one South African citizen to 40 years in prison afta e find her guilty of importing 5.75kg heroin into Nigeria through di Nnamdi Azikiwe International Airport, Abuja.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cqy8zgnm4nndo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Women for South Africa dey fear as police don discova di ninth bodi of woman wey dem kpai.
Some of di victims bin dey naked wen police find dia deadi bodi. Dem don promise reward to gbab pesin or pipo wey dey behind dis killings.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c8g49g53pv1ko -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
South Africa President Cyril Ramaphosa go take break from public engagements, di Presidency announce.
Di Presidency for one post on X on Wednesday tok say di president medical team advise am to rest and recova sake of say im fall sick.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cr3wjz0n2w2go -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Nigerian President Bola Tinubu don join many oda Nigerians to pay tribute to ogbonge actor Olu Jacobs wey kpai at di age of 84.
Olu Jacobs kpai afta im live wit dementia wit Lewy Bodies for some years.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/ckvgyrrgpg9mo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di president of di European Commission don support proposals for Canada to becom di first "associate member" for EU.
Canada dey seek closer ties wit EU afta dia relationship wit di US and President Donald Trump get k-leg.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c60qx42gy0pgo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Veteran Nigerian actor Olu Jacobs don die at di age of 84.
Im family announce im death on Wednesday, 16 September 2026, as dem describe am as “Di Lion of Lufodo”.
Oludotun Baiyewun Jacobs born on 11 July 1942.
Wetin you go miss about Olu Jacobs? -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Veteran Nollywood actor, Olu Jacobs don die.
Na di family announce am for social media early Wednesday morning.
www.bbc.com/pidgin/articles/ckvgyrrgpg9mo
#olujacobs #nollywood -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di National Drug Law Enforcement Agency (NDLEA) wey be di drug police for Nigeria don tok say dem no go allow Mexicans redirect dia production from oda places to Africa, especially Nigeria.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c6gmr4y4dmvvo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Kenya go bicom di first African kontri to host di World Athletics Championships afta dem win di bid for di 2029 edition.
Dem beat London to win di bid. Di capital Nairobi go hold di event for di 48,000-capacity Kasarani Stadium.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c9vgyderr753o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Many pipo don begin dey ask questions about di way individuals and oda groups dey traffic cocaine and oda drugs for Ghana.
Dem dey worry say Ghana dey become "transit hub for cocaine and oda hard drugs".
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cwq63v434lnpo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
South African authorities say dem don discova di bodi of anoda woman for Ekurhuleni as fear don begin rise about women safety.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cqj9xrnw1wlwo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
United States don confam say dem deploy space weapon for Earth orbit.
Dis na di first time US go acknowledge say dem get dis kain offensive capability for space.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/crkgwydw7jjqo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Police for South Africa don discova di deadi bodi of anoda woman for Kempton Park area, Gauteng.
Di murders of five women for di same area dey raise fear say serial killer fit dey for di area, but di police don dismiss dis fear.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cq4g7pj8rxjjo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Prime Minister Andy Burnham don cancel im engagements for Monday and Tuesday afta di death of im papa Roy.
E reveal say im papa no know say e don become prime minister for July, becos of im condition.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cw1l6rr2gvj6o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di late King Oyo Nyimba Kabamba Iguru Rukidi di Fourth go take im final journey home as dem go lay am to rest today for di royal burial grounds of di Tooro Kingdom for western Uganda.
Read how di burial dey go: www.bbc.com/pidgin/articles/c1kx0jxxjnwo
#tooroking #uganda #kingoyo #bbcnewspidgin -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di suspects dey accused of targeting more dan 100 women across di US and allegedly defrauding dem of more dan 100 million rand ($6.2 million).
Full tori: bbc.com/pidgin/articles/czrzp2mynemo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
At least 24 schoolchildren don die for stampede as dem dey try to escape one fire outbreak wey sweep through two schools for Bukavu, eastern Democratic Republic of Congo on Thursday, 10 September.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cpd09px744qo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Ondo State Ministry of Health don launch investigation into report of sudden and unexplained deaths for parts of Odigbo local govment area of di state, afta di deaths of more dan 30 pipo as odas dey hospital.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/ce8x493n9wdo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
One traditional Ugandan kingdom don select one television news anchor as di successor to King Oyo Nyimba Kabamba Iguru Rukidi IV, wey die last month at di age of 34.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cwyzwlwrpd9o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Na South Africa Minister of Justice and Constitutional Development Mmamoloko Kubayi tok dis one for im media briefing wia e add say dem don make progress for how dem go take handle immigration matter.
www.bbc.com/pidgin/articles/c70l7v5l21lo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Dem add say dem focus di leadership change for theatres wey still dey operational.
Dis dey come afta di United states announce say dem dey comot about 200 military personnel from Nigeria by di end of September.
www.bbc.com/pidgin/articles/cvgynzzq4rdo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Wetin happun to Peter Obi for Benue State still dey cause tok-tok for online and offline.
But Wetin Nigeria Constitution tok about restriction of movement for ogbonge pipo? E dey inside dis tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c36ljzxw8ezo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Appeal Court don uphold one court judgement wey sentence Robert Orya to 490 years for prison.
Orya na former Managing Director of Nigeria Export Import Bank (Nexim) wey chop prison sentence for 2.4 billion naira fraud.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c0re7pk125eo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
One shocking incident hapun for inside one courtroom for Fufore local govment area of Adamawa State, northeast Nigeria, wia one defendant attack di judge wey dey hear im case, and nearly cut off im hand wit cutlass.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c5y7kj2w9g1o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Govnorship election don begin today and candidates for 28 states wey dey participate for di poll go begin canvas for votes.
But rules of engagement dey, wetin candidates fit do and no fit do and how much dem fit spend.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c8d3ey520n6o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Benue State govment say di visit of Obi to di state no follow protocol.
NDC vice presidential candidate wey be Obi running-mate, Rabiu Kwakwanso tok say di attack on im oga for Benue na 'dark day for our democracy.'
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/czjzm7ez310o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Tigray People's Liberation Front (TPLF) don sama accuse on di African Union Special Envoy for di Horn of Africa wey be former Nigerian president Olusegun Obasanjo.
Wetin be dis accuse and Obasanjo mission for di Horn of Africa? E dey here: www.bbc.com/pidgin/articles/c209nv0g435o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Uefa Champions League don come back wit six ogbonge matches dis Tuesday, and already, football fans around di world don dey ask: who go win dis famous trophy for Madrid on 5 June next year?
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cwyzx011q0xo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Uefa Champions League don come back wit six ogbonge matches dis Tuesday, and already, football fans around di world don dey ask: who go win dis famous trophy for Madrid on 5 June next year?
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cwyzx011q0xo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Dem don bury di husband of Tanzanian President Samia Suluhu Hassan, Hafidh Ameir Hassan for Kizimkazi, Zanzibar.
Oga Ameir, di late First Gentleman wey dem born on 1 January, 1946 leave behind two widows, four children and 15 grandchildren.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c980jjeqm12o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
According to di Dangote Group, di facility go be di world largest Single-Train 650,000 barrels per day Petroleum Refinery wit 900 KTPA Polypropylene plant.
At full capacity, e dey expected to meet 100% of Nigeria requirement of all refined products.
www.bbc.com/pidgin/articles/c046dv367v4o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Tins like dis don happun bifor wen about 600,000 pikin no go school for three years wen crisis start for 2016 and some parents don carry dia pikin go oda areas.
www.bbc.com/pidgin/articles/cn8m1vrn9vxo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Hafidh Ameir Hassan, husband of President Samia Suluhu Hassan, don die.
Vice President Deogratius Ndejembi make di announcement on Monday, 7 September.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c980jjeqm12o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Five pipo don kpai and five odas dey seriously injured afta one Amazon Air cargo plane overshoot di runway as e try to land for Miami International Airport.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cqlw06xx5wro -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Nigeria get 36 states but ADC dey present candidates for 28 states. Wetin happun to di remaining seven states and who be dia 28 governorship candidates for di 2027 elections.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cjw5vxq0494o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di fight sup yesterday wen members of di March and March movement say dem go do clean up for some streets for Durban area - na so di clash start wey later lead to serious fight wia pipo begin dey throw stones and sticks to hit dem sefs.
www.bbc.com/pidgin/articles/c7903y8rj88o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
President Yoweri Museveni alongside govment officials, family and friends receive di deadi bodi of di 34-year-old king wey arrive for Entebbe Airport today.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/ceq8rzqvw98o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Anthony Joshua and Tyson Fury don lock in to bring one of di biggest British boxing matches wey fans don dey expect for long.
Afta boxing lovers don wait for dis ogbonge fight for a long time, finally e dey expected to happun for November.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cx2z5xq5gdxo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di deadi bodi of di late Omukama of Tooro Kingdom, King Oyo Nyimba Kabamba Iguru Rukidi IV, don arrive for Uganda from United States.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/ceq8rzqvw98o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Nigerian govment don dismiss claims wey dey circulate on social media say Nigeria and di Economic Community of West African States (Ecowas) back di recent failed coup for Niger.
Wetin be Nigeria relationship wit Niger? E dey inside dis tori: bbc.com/pidgin/articles/cg59qg9my9mo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Local media dey report say na ova 30 pipo kpai for di incident and police say na 10 pipo die - but wetin we know be say search dey go on to find more deadibody.
Full tori dey hia: www.bbc.com/pidgin/articles/c39mj09e73eo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
On Saturday Niger witness military attack for some strategic locations afta sojas fight to restore order - dis na di latest challenge to military ruler Abdourahamane Tiani, wey im govment for long time now dey battle serious jihadist insurgency.
www.bbc.com/pidgin/articles/cx2z0wlxlg6o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Sources for Kebbe town reveal say di bandits initially give residents five-day ultimatum to raise di money.
One source for di community say dem don alert police of di mata.
Full tori dey hia: www.bbc.com/pidgin/articles/cgmr8vye0kyo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Senator Sharafadeen Alli bin come under criticism afta di circulation of one video wey show am interacting wit students during one interview.
Full tori: bbc.com/pidgin/articles/cvgypgjgkz3o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Just like Uber, some oda major foreign companies don leave di kontri sake of one reason or di oda.
Hia na list of ten companies wey don comot for Nigeria in di past five years: www.bbc.com/pidgin/articles/c8047r1l2l3o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di House of Representatives Ad Hoc Committee don clear di Chief of Staff to di President, Femi Gbajabiamila, of involvement for di activities of di Presidential Foreign Intervention Promotion Council.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cj3dx16v030o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
You don hear di tori wey dey spread say Opay dey shutdown for Nigeria?
Opay na fintech company wey dey operate for Nigeria wit several customers wey include businesses too.
Dis na di true informate about wetin Opay tok ontop dia stay for Nigeria.
#opay #opaynigeria #bbcnewspidgin -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Afta about 12 years, Uber announce say dem dey shutdown operations for Nigeria.
Di company say na very difficult decision for dem to comot from Nigeria.
But why and wetin go happun to users and drivers.
Read full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/clyrdnn27e4o
#uber #ubernigeria -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Fintech company OPay say no be true say dem wan close down and pack comot from Nigeria.
Chief Operating Officer of di company Dotun Daniel Adekunle tell tori pipo on Wednesday say di tori wey dey trend na fake news by haters.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c9v9y13wv8zo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di United States go withdraw about 200 military personnel from Nigeria by di end of September.
Dis go bring to di end one counter-terrorism deployment wey aim to help Nigerian forces fight Islamist militants.
www.bbc.com/pidgin/articles/cx2zx7e4xppo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Atiku Abubakar claim say di name ontop di NYSC certificate wey President Bola Tinubu submit to Inec na 'Tinubu Bola Adekunle', while di official name of di President wey evribodi know na 'Bola Ahmed Tinubu'.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c07lzv941j1o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Iran don launched missile and drone attacks for US targets across di Middle East, afta American forces resume strikes against Iran.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cew9knejz22o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
South Africa don appoint new head coach of di Bafana Bafana to replace Hugo Broos.
Hugo Broos wey step down afta five years for di role wen im contract expire for di end of July.
Who be dis new South Africa coach wey dem hire?
Read tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c0kl5k32veeo
#bafanabafana -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
As political parties and candidates dey increase dia preparations for di 2027 general elections, di issues wey fit influence voters choices dey become more important.
Full tori: bbc.com/pidgin/articles/cqlwdne3gr5o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di 2026 football summer transfer window for di English Premier League go close by 23:00 BST dis Tuesday, dat na 11:00 PM Nigeria time.
Here na some of di big transfers wey clubs dey look to finalise on dis deadline day.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/ckg7y7lxnn3o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di death toll for Nepal from floods on di border wit Tibet don pass 1,000, according to di kontri disaster agency.
More dan 3,900 pipo still dey miss.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cx2zmr20nmlo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Dem don find former gang boss Duane "Keffe D" Davis guilty say im arrange pesin to kill rapper Tupac Shakur.
Dis go be di first conviction in di cold case wey don hold hip-hop fans for neck for almost 30 years.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cd79dl0yj82o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
New satellite images don reveal di scale of di destruction along Nepal Trishuli River caused by di deadly flash flood.
Di images show how sections of di valley, wia plenty floodwater rush pass, destroy villages, bridges and hydroelectric power stations.
www.bbc.com/pidgin/articles/cx2zmr20nmlo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Argentina player Lionel Messi don announce im retirement from di National Team.
Dis decision dey come afta di World Cup outing.
Messi say di decision 'hurt im soul.'
Read full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c5ydeq973ngo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Hauwa Jidda Suleiman first discova say she no get fingerprint wen she go register for Joint Admissions and Matriculation Board (Jamb) exam.
Na condition wey dem dey call adermatoglyphia cause am. But wetin be dis condition and e get treatment?
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cvgyl8yw10eo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Number of missing pipo for Nepal don rise to 4,247 since flash floods hit di kontri last Wednesday.
Authorities say number of confirmed deaths na 903 so far as rescue operations continue five days afta di incident.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/ckgvnl1x622o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Nigerian President Bola Tinubu don formally raise concern sake of di xenophobic and Afrophobic attacks against Africans and oda foreign nationals for South Africa bifor di African Union.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cm279nmxvzgo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
South Africa don set 31 August as deadline for married couples to regularise dia customary marriages and make am legal for di kontri.
South Africa Home Affairs say many couples fail to register dia customary marriages.
Read full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/clye22qz49jo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di former vice president of Nigeria Atiku Abubakar don express concern say di kontri na one of di poorest kontris for di world.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/crm9zeye3xno -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
King Harald V of Norway don die at di age of 89, afta dem carry am go hospital last week make doctors treat am for one rare blood condition.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cn5dw11971zo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Former Vice President of Nigeria Atiku Abubakar don assure Nigerians say im go control di insurgency and insecurity problem for Nigeria within one year wen e enta office.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/crm9zeye3xno -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Tok-tok don already start about di club wey fit win di Uefa Champions Leage dis season but na wen dem do draw fans fit know weda dem go fit survive di league phase or not.
www.bbc.com/pidgin/articles/c3relr8qrn0o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di chairman of Nigeria anti-corruption agency, di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC), don announce anoda whistleblower policy wey dem tok say fit make pipo "multi-millionaire in your lifetime".
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c0e31vw4le0o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
For dis law, pipo wey commit petty crimes like assault, traffic offence, publication of false news, petty theft, public nuisance, unlawful assembly among odas, go work for di community.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cy0zg0yjnnro -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Sixty-seven Nigerians don return from South Africa under one privately funded repatriation programme, Nigerian officials tok.
Dis dey come just about one week afta anoda 83 pipo bin also come back to Nigeria from South Africa on 18 August.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cr7d59rlg5mo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
More dan 800 pipo still dey miss for Nepal afta massive flash flood on di border wit Tibet.
Di flash flood bin wash away villages and destroy roads and infrastructure.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/ckgvnl1x622o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Prosecutor for Finland dey demand more prison sentence for Biafra separatist leader Simon Ekpa for di Court of Appeal dan wetin di District Court sentence am to last year.
Ekpa dey serve six years jail term for terrorism.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cx2z5v4lerpo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Biafra separatist leader, Simon Ekpa, wey dey serve six years jail for terrorism don enta courtroom for Finland to appeal di District Court decision wey sentence am.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cx2z5v4lerpo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
As ‘Mama of all protests’ dey load for South Africa, more Nigerians dey expected to arrive for di kontri today.
Sixty-five of dem go land today afta 83 bin arrive for di kontri last week.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cr7d59rlg5mo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Trump administration dey plan to cancel di visas of foreign citizens wey bin enta di US as short-term visitors and later apply for asylum.
Dem also propose to apply di fee of $103,265 to applicants of H-1B visas.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cnvlynm0edqo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Snaresbrook Crown Court for UK don confam say Nigerian dancer and entertainer Iweh Pascal Odinaka aka Poco Lee go appear bifor dem for plea and trial preparation on Tuesday, 15 September 2026.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cr4v0velrxvo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Niger State Police command don confam say suspected terrorists enta one community for di state on Friday 21 August, 2026.
Full tori: bbc.com/pidgin/articles/cx2zy66pvrro -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Three suspects go appear for court on Tuesday, 25 August ova di murder of South African boxing world champion Zolani Tete.
Dis dey come afta one suspect ontop wheelchair appear for court on Monday, 24 August.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cqxvj8v59xlo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
At least 31 pipo don kpai afta mound of rubbish for one major waste site collapse ontop nearby homes for Guinea capital Conakry, di govment tok.
Anoda 22 pipo injure, including six seriously, for di city of Dar-es-Salam.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c5yd3w2zzl0o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Nigerian actor Taiwo Hassan wey pipo sabi as Ogogo don make im final journey home as family, friends colleagues pay dia last respects.
For di burial, Ogogo best and fellow actor Yinka Quadri break down in tears and pipo begin console am.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c5yl3pn7e95o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Ogbonge Nigerian actor Taiwo Hassan aka Ogogo dey make im final journey home as family, friends and colleagues dey give dia last respect to one of Nollywood greats.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c5yl3pn7e95o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
At least 30 pipo don kpai afta mound of rubbish for one major waste site collapse onto nearby homes for Guinea capital Conakry, di govnt tok.
Anoa d22 pipo injure, including six seriously, for di city Dar-es-Salam area.
www.bbc.com/pidgin/articles/c5yd3w2zzl0o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Nigerian actor Taiwo Hassan wey many pipo sabi as Ogogo go make im final journey home on Monday, 24 August afta im death on Sunday, 23 August at di age of 66.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c5yl3pn7e95o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Wen you hear 'action po bi Ogogo', na only one name fit come your head.
Na slang wey dey common for street till today becos one man sabi show plenti actions.
Even GenZ wey fit no sabi wia dat slang come from go surely sabi Taiwo Hassan 'Ogogo'.
Wetin you rememba about #ogogo? -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Nigerian veteran actor Taiwo Hassan alias Ogogo don die.
Im colleague Jide Kosoko announce and confam di death of Ogogo on Sunday.
Ogogo battle stage 4 cancer for several weeks bifor di news of im death begin trend.
#ogogo #taiwohassan
www.bbc.com/pidgin/articles/cy5d5d59yq3o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
ICPC say dem don discover new fake agency for Nigeria.
According to di ICPC, di pesin wey dey promote dis new fake agency dey use four different names.
President Bola Tinubu don chook mouth order arrest of di promoter.
Read full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cp8x8nn7nj5o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di new Premier League season go start on Friday, 21 August 2026 wit di title holders Arsenal.
Dem go jam wit Frank Lampard im promoted team Coventry City for di Emirates stadium.
See oda tins you gatz sabi for di new season: www.bbc.com/pidgin/articles/cqjxnn7wj2do -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di couple move from California dey come afta dem comot UK and royal duties for early 2020.
Family relations no too smooth since den. July visit to di King and Queen Camilla na key development for dia relationship.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c8ennp4yk2ko -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
For dis tori, we put togeda few Nollywood actors and actresses wey die from cancer and dose wey fight am and still dey kampe.
Full tori: bbc.com/pidgin/articles/c5ywnp2008xo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Campaigns for di 2027 presidential and National Assembly elections don formally start on Wednesday, 19 August 2026, and dis mean say activities wey go lead to di election don begin.
Dis na di states wey bin decide Nigeria previous presidential elections: www.bbc.com/pidgin/articles/cjwxev029w3o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di National Drug Law Enforcement Agency (NDLEA) no dey joke about dia clampdown on drugs.
Dem seize $28m worth of cocaine wey dey go UK and gbab social media influencer.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cz05zj9nv73o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Nick Kyrgios don provisionally dey suspended from tennis afta e test positive for cocaine.
Di Australian bin submit sample during di Mallorca Open on 22 June wey dem later find to contain benzoylecgonine, wey be metabolite of cocaine.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cn4n9wllw10o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Cape Town regional court dey expected to hand down judgement on her immigration status and di bid wey go stop her detention bifor her deportation case.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c3ekl4y0zxlo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
"Na war, wen you get 17 govnors, 50 senators, house of representatives wey dey against one man and den im come out victorious, God dey good," Davido tok.
On di 2027 election, di Grammy award nominee say im neva decide candidate to support.
www.bbc.com/pidgin/articles/c998dd18v5vo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Afta di pikin of veteran Yoruba actor Taiwo Hassan alias Ogogo, announce say e battle cancer, fans and loved ones don dey pray for im recovery.
But di tori change afta one of im daughters post about her papa for social media dis afternoon.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/cdew04gggydo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Nigerian authorities don tok say dem seize cocaine wey dey go di United Kingdom, and wey worth estimated $27.7m (N39bn).
Two key Nigerian suspects don chop arrest as part of di investigation, including one social media influencer.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cz05zj9nv73o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
President Hakainde Hichilema don win di 2026 Zambia presidential election as e gada more dan 60 percent of di votes for di election.
Di Zambia Electoral Commission announce di final results from all di 226 constituencies.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/czrjzexnl17o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Dis dey come afta March and March anti-immigration group give new deadline of 30 September for all illegal migrants to comot for South Africa.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cly8mj9xwjro -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Una Good morning!
Today proverb na from Ihechi Aji
Tell us how una reason am and drop your own for comment section.
#proverboftheday #bbcnewspidgin #proverb #wisewords #wordsofwisdom -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Oman wey dey claim say dem dey neutral for dis conflict, don suffer some attacks from Iran since di gbege start. However, dem dey try negotiate wit Iran to reopen di strait.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/cwy4z73n3dno -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Chief Raji Adeleke family remain one of di most successful and powerful political and entertainment families for modern Nigerian history.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cyvlz477vv5o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Barcelona don agree deal to sign Spain captain Rodri from Manchester City for about £65 million.
Dis na oda top transfers wey don hapun dis window.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cm2grz3xvzpo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Trump administration end TPS as part of di temporary humanitarian programme wey bin allow eligible citizens of some kontris for di world to remain for di US until wen dia kontri dey good and safe for dem to go back.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c20e76k9znvo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Dis dey happun two months afta dia 30 June deadline for foreigners to comot for dia kontri sake of dem say di foreigners don collect dia jobs, dia women and dia businesses.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cwyqz18d54zo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Cameroon lift dia first eva Wafcon trophy afta dem beat Malawi wey bin play for di tournament for di first time.
Dis na how di match waka: www.bbc.com/pidgin/articles/cdew0yxj9r1o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Presidential Candidate of di ADC for di 2027 Nigeria general elections and former Vice President Abubakar Atiku don hail Osun State govnor-elect Ademola Adeleke for im victory at di polls for di just concluded govnorship election.
Live updates: www.bbc.com/pidgin/live/c6wye040jzj3t -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Independence National Electoral Commission (Inec) don declare Ademola Adeleke as winner of di Osun State govnorship election wey happun on Saturday, 15 August.
See breakdown of results for hia: www.bbc.com/pidgin/articles/c15119z5ello -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Governor Ademola Adeleke don win re-election as di govnor of Osun state. E win 19 out of di 30 LGAs wey dey di state.
Here na di 19 LGAs and dia votes: www.bbc.com/pidgin/live/c6wye040jzj3t -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Returning Officer Joshua Olalekan Ogunwole declare Ademola Adeleke of di Accord Party di winner of di Osun governorship election wit 511,067 votes.
APC Bola Oyebamiji poll 444,815 votes, while ADC Najeem Salam score 17,180 votes.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cjwxxvvn8z4o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
While di infection dey affect pipo of both sexes and children, e dey common wit women. Half of women for di world dey experience UTI at some point for dia life.
But how you fit take avoid UTI: www.bbc.com/pidgin/articles/cqx7q8d4jy9o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di candidate of di African Democratic Congress (ADC), Najeem Salaam, don lose im local govment to di candidate of Accord party, Govnor Ademola Adeleke.
Follow live updates for here: www.bbc.com/pidgin/live/c6wye040jzj3t -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Bola Oyebamiji of di All Progressives Congress (APC) don win im local govment, Irewole, for di Osun State govnorship election.
Oyebamiji poll 29972 votes to defeat Ademola Adeleke of Accord wey get 10934 votes.
Live updates: www.bbc.com/pidgin/live/c6wye040jzj3t
#osunstateelection2026 -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Govnor Adeleke of di Accord party don win im local govment, wey be Ede.
E defeat di Bola Oyebamiji of di All Progressives Congress (APC).
Govnor Adeleke get 35,427 votes, while Oyebamiji get 10283 votes.
Follow live updates for here: www.bbc.com/pidgin/live/c6wye040jzj3t -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Inec don begin announce di Osun State govnorship election results by local govments.
See di results for here: www.bbc.com/pidgin/articles/c204y077weqo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Follow di live updates for di collation of Osun State govnorship election results: www.bbc.com/pidgin/live/c6wye040jzj3t
-
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Candidate of di All Progressives Congress for di Osun State govnorship election Bola Oyebamiji don win im polling unit for Ward 9, Unit 11, Open Space, Gantry Sawmill, for di Irewole govment area, Ikire. E poll 709 votes.
Follow live updates for here: bbc.com/pidgin/live/c6wye040jzj3t -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Osun State Inec collation centre don ready for arrival of results from different local govment areas.
As at now, no local govment don bring in dia results.
Follow live updates for here: www.bbc.com/pidgin/live/c6wye040jzj3t
#osunelection -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
According to Section 179 of di Constitution of di Federal Republic of Nigeria (as amended), di winner of di election gatz satisfy two important conditions.
Follow live updates for here: www.bbc.com/pidgin/live/c6wye040jzj3t -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Govnor Ademola Adeleke of Accord party don win im own polling unit.
Adeleke defeat im rival Bola Oyebamiji of APC wit 421 votes. APC get 29 votes.
Follow live updates for here: www.bbc.com/pidgin/live/c6wye040jzj3t
#osunelection -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
At least 47 pipo don die afta one magnitude 7.7 earthquake strike Indonesia early Saturday morning, di nation disaster mitigation agency tok.
Di official death toll dey rise as search and rescue operation dey go on.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/ceqeexlj75xo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di govnor of Osun State and candidate of di Accord Party for di ongoing election don condemn di alleged arrest of state Peoples Democratic Party chairman, Sunday Bisi.
Follow live updates for here: www.bbc.com/pidgin/live/c6wye040jzj3t
#osundecides2026 -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Accord candidate and current govnor Ademola Adeleke major opponent na Bola Oyebamiji of APC wey get di support of di president.
Counting of di result go start afta di election end by 2:30pm today.
Enta here to see live results: www.bbc.com/pidgin/articles/c204y077weqo
#osunelection2026 -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Tori pipo don confam say di candidate of di ADC safely comot for di area wey kasala bin happun.
Kasala bin burst for Najeem Salam polling unit and we hear say e escape through anoda route.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/live/c6wye040jzj3t -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Malawi Women football team, di Sorchers, surprise football fans as dem qualify for dia first ever Women Africa Cup of Nations final.
But e get two women wey don make am happen -Temwa Chawinga and Tabita Chawinga.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cx2j1j5d1eno -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di candidate arrive for im polling unit 11, ward 9, Gantry Are for Ikire, Irewole LGA wit im wife and party faithfuls to vote dis morning.
Live update: www.bbc.com/pidgin/live/c6wye040jzj3t -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Action Democratic Congress (ADC) govnorship Candidate Najeem Salam don cast im vote for Polling unit 13 Ward 04 Ejigbo LGA of Osun state.
Follow live updates: www.bbc.com/pidgin/live/c6wye040jzj3t
#osundecides2026 #osunelection2026 #adeleke #davido #oyebamiji -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
"Di election must dey transparent, free and fair. I urge Inec to ensure di integrity of di process” - Na so President Tinubu tok.
www.bbc.com/pidgin/live/c6wye040jzj3t
#osunelection2026 #adeleke #oyebamiji #inec -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Governor Ademola Adeleke don cast im vote for im polling unit 9, ward 2 for Ede North Local Government Area of di state.
Our tori pesin Adesola Abisoye say di govnor come di polling unit wit some members of im family.
Live updates: www.bbc.com/pidgin/live/c6wye040jzj3t
#osundecides2026 -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di governorship election for Osun state don start wia 2.3 million registered voters get chance to decide who dia next govnor go be.
Di election wey get 15 candidates go hot sake of di interest wey dey inside.
Live updates: www.bbc.com/pidgin/live/c6wye040jzj3t -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Dem don find former Cambridge University academic Jason Arday dead for im house for London.
Metropolitan Police say di London Ambulance Service call dem at 3:12pm today.
Dem find Arday 'unresponsive' for di property for Battersea.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cd7lw0epz30o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Nigeria Football Federation wey be di football govning bodi of football for Nigeria don set up committee wey go chook eye inside football for di kontri.
Di mandate of di six-man committee na to find out why football no dey go well for Nigeria again.
bbc.com/pidgin/articles/c304yzrj6r3o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
United States authorities don confam say kidnappers don release American missionary pilot, Kevin Rideout, wey dem kidnap for Niger capital Niamey for October last year and e go soon land for US.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cz97ly77735o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Prichard Colon, wey bin suffer severe brain injury during one fight for 2015 don die at di age of 33.
Colon collapse for im changing room afta di fight wit Terrell Williams.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c9v427yv4p9o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
"Di two side agree say plenty work still dey to do especially as e concern support for IDPs."
Dis na di second meeting of dis joinbodi group. Di first one bin hapun for di Nigeria capital Abuja for January 22, dis year.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cz7d50gl4vgo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di pardon wey Chad president Mahamat Deby grant Masra and di oda eight political actors, no mean say dem don get amnesty.
Dis mean say dia sentence still dey ground for prosecution, di Presidency announce.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/c62v1gxwj59o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Super Falcon players dey emotional afta di game - Michelle Alozie na one of di players wey cry for di pitch, but dia captain Rasheedat Ajibade tok say teams for di continent don become beta na so dem gatz raise dia game also.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/c9d83wwgw6wo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Bird wey dem dey usually link to death and sometin wey don rotten, maybe e no dey surprising say wen vultures disappear from di skies across many cities for West Africa, pipo no miss dem.
#bbcnewspidgin #vultures #wildlife #extinction -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
US President Donald Trump no dey joke wit pipo wey dey go US go born pikin so di pikin go be US citizen.
Di American president don establish task force to end am.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c62qxprwqpwo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Ghana National Tomatoes Traders and Transporters Association don announce say dem no too sure about di practical implementation of one defence deal between Ghana and Burkina Faso.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cx2r19enjm0o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Nigeria go jam South Africa, Ghana go face Ivory Coast for di Women’s World Cup playoff.
Malawi, Algeria, Morocco and Cameroon secure dia spot, two more spots remain for teams from Africa.
Wetin be your prediction for di two games today?
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c9d83wwgw6wo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Goalkeeper Michaely Bihina arguably na one of di best players for di competition.
In fact, for some fans, Cameroon gatz build statue for her; afta she use her hands power di Indomitable Lionesses to di Wafcon final.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/cp3rp60dv55o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Two weeks before she release her new album, Starrgirl, di Nigerian singer post picture of hersefbfor hospital afta she undergo "major surgery".
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/cvg0zl29zg1o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Bifor her tenure for di White House as press secretary, she bin don dey work wit Oga Trump for a long time, first as assistant press secretary and speech writer during im first term in office.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/cr7kpx4jdggo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
One man for one part of south-eastern Nigeria, dey try stop di trend wey wan wipe out vultures from Nigeria.
Awka-Etiti na home to one sacred forest wey surround shrine wey dey dedicated to a deity dem sabi as Nguma.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c1l122leqvro -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Malawi enta di history book as dem become di seventh different nation to reach di final since di first tournament under di current format in 1998.
Malawi na di first Wafcon newcomers since Zimbabwe for 2000 to reach di finals.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/c0rd2q1z25ko -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Na 14 candidates Inec list for di Osun governorship election.
As di alection day come closer, hia na brief profile of some of di candidates for di election.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/c36dre7g53zo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Dis reaction dey come afta South African govment claim say dem spend 292.77m rand ($18m; £13.5m) to accommodate and transport tens of thousands of migrants wey dem deport or di ones wey choose to return to dia home kontris.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c78gq7gy581o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di debate on weda judges of di superior courts of Ghana suppose dey go on vacation don start again.
Dis dey come afta lawyers for ex-govment officials wey dey face criminal charges say dem no go dey available during two-month legal vacation.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cvg0zwgn8pdo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
As Nigeria comot for dI quarter-finals stage for di ongoing Women Africa Cup of Nations (Wafcon) 2026, e give oda kontris chance to become champions.
Nigeria wey don win di title record 10 times don create chance for new winners to emerge.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c0rd2q1z25ko -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Police don ask di senator, wey be member of di All Progressives Congress (APC) to appear bifor di State Criminal Investigation Department (SCID) for Osogbo today.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/c75g9wynzg5o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Ginger don dey too much for di Osun state governorship election.
Di election na one of di off cycle elections wey dey happun across Nigeria. Dis na sake of court judgement wey bin remove one sitting govnor and install im opponent for 2017.
www.bbc.com/pidgin/articles/cz970pxj50vo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Ronaldo first meet Rodríguez wen she bin dey work as a sales assistant for one Gucci store in 2017.
For one Netflix series Ronaldo say e see Rodríguez as "very interesting girl, so much more mature for her age," but say e bin no expect di romance to last.
www.bbc.com/pidgin/articles/cx2rd9djm37o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
On 13 August, more dan eight million registered voters go get chance to choose president and new parliament.
President Hakainde Hichilema want anoda five years afta im landslide win ova Lungu for 2021 on a platform of change.
www.bbc.com/pidgin/articles/ce97mpp8243o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Family and friends of Nigerian Law School student Faith Alayande still dey mourn her death.
According to Nigerian Law School, Faith fall from di rooftop of her hostel and on Friday, 7 August.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c4gx5vjwq9qo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Davido don call on US President Donald Trump say make e chook eye for Osun State govnorship election wey go happun on Saturday, 15 August.
E also call on di international community as e say violence fit happun on dat day.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cnvn8pdj3pzo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Davido don call on US President Donald Trump say make e chook eye for Osun State govnorship election wey go happun on Saturday, 15 August.
E also call on di international community as e say violence fit happun on dat day.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cnvn8pdj3pzo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
One video don go viral for social media, wia one man dey claim say Emir of Kano, Muhammadu Sanusi II carry im entourage ente school campus to challenge im "carry over". - but di Palace say na lie.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/crl714np294o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Nigerian Law School don confam di death of one of dia students, Faith Alayande wey die from heavy fall from di hostel rooftop for Lagos Campus, according to statement from the school.
But wetin we know? www.bbc.com/pidgin/articles/c4gx5vjwq9qo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di South African govment don release travel warnings across di kontri dey tell pipo to dey vigilant and exercise caution as heavy snowfall, freezing conditions, heavy rain and strong winds dey currently happun for many parts of di kontri.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/c9v4lxrerelo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Last month, Donald Trump secretly travel from Turkey go Britain inside one small military plane - White House neva react to di tori.
But how e take happun?
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c0ej75871nro -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di kontri aviation authority don report damage for many regional airports, including di ones wey dey Pereira, Manizales, Quibdó, Armenia, Cartago and Buenaventura.
Di quake come less dan two months afta di one wey kill more dan 6,300 pipo for Venezuela.
www.bbc.com/pidgin/articles/cevmkedyx88o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Death toll from Colombia 7.4 magnitude earthquake don rise to 111.
Dis earthquake dey come less dan two months afta twin quakes destroy parts of Venezuela, wey kill more dan 6,100 pipo.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cevmkedyx88o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
At least 20 pipo don kpai afta one powerful earthquake hit western Colombia, according to local officials
Di magnitude 7.4 quake strike on Monday at 07:34 (12:34 GMT) and reach depth of 107km (66 miles), di US Geological Survey tok.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cevmkedyx88o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Senior police detective Frans Mathipa don dey fight for four months make e get access to one ogbonge informate for di case wey e bin dey work on.
E bin fear say dis investigation fit cost im and dis na wetin happun to am.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c0ej7n9yw28o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Both Iran and Oman don tok say negotiations ova new arrangement ontop how to manage traffic wey dey pass di Strait of Hormuz don dey "positive" and dey advanced stage and e dey lead to hope say shipping traffic go fit start again.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/ckg3en5vg07o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Typhoon Dolphin carry maximum wind speed of 150km/h (94mph) wen e first hit Yuhuan for Zhejiang province on Sunday bifor e land for Wenzhou city about one hour later, meteorological authorities tok.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/cdx8dlr1vv7o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
E don pass three decades since dem kill rapper Tupac Shakur.
E die on 13 September 1996 at di age of 25, afta dem shoot am four times for Las Vegas - and "Keffe D" Davis dey face one charge of murder.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c39e3km40kvo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Debutants Malawi sama both Nigeria and Ghana on dia way to dia first ever Wafcon semifinal and historic World Cup qualification.
And yesterday, di two kontris crash out of Wafcon. But how dem fit take reach di 2027 Women's World Cup?
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/cgq5k2p4n1wo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Nigeria dey face dia neighbour Cameroon for di Wafcon quarter-final match.
Wetin be your prediction?
Follow live updates for here: www.bbc.com/pidgin/articles/c07rjvj9z3do -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di three kontris, wey make up di Alliance of Sahel States, summon Nigeria charge d affaires to Burkina Faso capital, Ouagadougou and accuse im president Oga Tinubu say e present "inaccurate" view of events for di region wia attacks by jihadists dey mount.
www.bbc.com/pidgin/articles/c9q9p1xv9p9o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
President John Mahama appoint Adjei one year afta di former defence minister Edward Omane Boamah die for military helicopter crash wey crash near Adansi Akrofuom for Ashanti Region.
Di full cabinet reshuffle: www.bbc.com/pidgin/articles/cp8x02pg6n2o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Jason Arday, wey be professor of education also dey face accuse say e forge or exaggerate some tins for im CV.
E don defend imsef and im work.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cy0j7z8jk0eo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Fresh details don emerge about di release of 308 pipo wey Nigerian authorities say dem rescue from kidnappers den.
Victims don share wit BBC wetin dia eye see for kidnappers den.
www.bbc.com/pidgin/articles/c20j51lxve8o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Confederation of African Football (Caf) on Thursday “unanimously reconfam dia support for Fifa President Gianni Infantino” afta im failed plan to sell stakes for di World Cup.
But why Africa dey support Infantino? E dey inside dis tori:
www.bbc.com/pidgin/articles/c86nv1q9265o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Govnor Ademola Adeleke of Osun State don drag di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) go court afta dem freeze di state account.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/ckg6980d088o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Kano State govment on Friday, 7 August, go join 3,000 men and women for marriage under one mass wedding programme wey di state govment dey organise from time to time.
Dem bin open application for both Muslims and Christians: www.bbc.com/pidgin/articles/c8en90k733ro -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Afta weeks of investigations, Independent Corrupt Practice and Other Related Offences Commission (ICPC) don finally submit dia report to President Bola Tinubu ova Adeniyi Adeyemi fake agency.
Di commission make some recommendations to di federal govment.
www.bbc.com/pidgin/articles/c5y3j170kx0o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
ICPC chairman tell tori pipo about di findings of dia investigations ontop di fake agency mata.
E tok say dem discover two more fake govment agencies wey dey linked to Adeyemi, di fake director-general of PFICP.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/c5y3j170kx0o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Cambridge university say dem don launch investigation into Professor Jason Arday "afta new information" about im "academic qualifications and honorary appointments".
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cy0j7z8jk0eo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Wetin make pipo tok wella on to dis mata be say, Rihanna wey be musician and business woman wey her real name na Robyn Fenty neva drop full album since Anti wey she bin release for 2016.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c1d1z966779o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di president condemn di timing of di EFCC action as e say di time wey e happun go make pipo feel say di federal govment dey interfere wit di election.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/ckg6980d088o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
EFCC don explain why dem freeze di account of di govment of Osun State, for di southwest region of di kontri.
But shey EFCC get constitutional power to freeze di state govment account? E dey inside dis tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c4g394rlk06o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Nigerian Army say dem go give correct amount of money to any member of di public wey go fit provide credible information ontop di location of most wanted commanders and terrorists of di Islamic State of West Africa Province (Iswap).
Full tori: bbc.com/pidgin/articles/cgjen0ny631o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di opposition party for Ghana, di New Patriotic Party (NPP) dey protest wetin dem describe as ‘Democracy Under Attack’.
Dem say among oda tins, di National Democratic Congress (NDC) govment dey oppress dem, wey dem dey clampdown on free speech.
www.bbc.com/pidgin/articles/c75gvkqz16ko -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Nigerians dey mourn di death of popular actress Tope Osoba wey kpai at di age of 40 years.
Her family confam her death on Wednesday, 5 August, di same day wey she kpai.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c1k1pgx21y4o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Vinicius sign contract extension for Real three years ago - e go end for 2027, but di club and im representatives don dey tok about fresh deal for di past 18 months.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/c3r07p77y35o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Nigerian govment bin approve upward review of military personnel salary by 30, 50 and 80 percent.
How much Nigerian military personnel dey earn now and wetin go be dia new salary? E dey inside dis tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c8xndp0n1zpo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Freezing of di Osun state govment account na di latest for di series of battles wey dey face di southwest state ahead of di govnorship election wey go hold on 15 August.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/ckg6980d088o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Josiah Dangut, di head of Waec for Nigeria, tok say total of 1,200,514 candidates, wey be 61.54%, get credits and above for at least five subjects, including English and Mathematics, out of di 1,950,726 candidates wey sit for di examination
www.bbc.com/pidgin/articles/crl79x0y9jwo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Nigeria Super Falcons go face Female Pharaohs of Egypt on Wednesday for di Group C final match for di ongoing Women African Cup of Nations 2026 for Morocco.
Who you tink say go win? Respond wit di kontri flag.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cgk4e1p41rdo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Some students of di Obuasi Senior High Technical school don allegedly attack dia headmaster for Wednesday dawn.
Dis na afta dem accuse am say im dey do rituals for night on campus.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c3w07e627qlo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Former South Africa president and leader of di uMkhonto weSizwe Party ("MK Party"), Jacob Zuma, don announce leadership changes to di party.
Jacob Zuma wey also be di president of MK party sack di current leadership of di party and appoint new ones.
www.bbc.com/pidgin/articles/c39epl9gee4o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
For last month July, Nigeria Defence Minister Christopher Musa start ogbonge controversy wen e reveal say President Tinubu administration don increase di minimum wage for Nigeria soldiers to 100 thousand naira, dat na less dan $100.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/c0l572d0r4yo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di family wahala wey surround music and royalties during dia time as P-Square bifor dem separate don show face again as dem dey accuse and counter accuse one anoda.
www.bbc.com/pidgin/articles/c89n15xqypwo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di 93-year-old president appoint officials to key positions within di army and e promote five colonels to di rank of brigadier general.
But di concern be say Paul Biya dey do all dis tins from abroad and e don tey wey im kontri pipo see am for public.
www.bbc.com/pidgin/articles/c141p502vp6o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di political tension for Osun State dey grow day by day as di govnorship election dey draw close wit major aspirants trading words and accusation including security breakdown.
Govnor Ademola Adeleke don also cry out to President Bola Tinubu to intervene.
www.bbc.com/pidgin/articles/cvgj772lnpgo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Nigeria govment dey invite citizens to contribute to di process of di state police wey dem wan create.
Dis na how you fit participate: www.bbc.com/pidgin/articles/cy0jy7j7346o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Popular Kenyan pan-Africanist, Patrick Lumumba, don call on di govment of South Africa to pay compensations to fellow Africans wey lose dia means of livelihood for di recent anti-immigration attacks for di kontri.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cr493343w0vo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Women's Africa cup of nations competition don dey enta business zone as kontris don dey qualify for di quarterfinals.
16 kontris dey fight for one trophy for di 35-year-old competition.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c8xn1d1eqx9o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
www.bbc.com/pidgin/articles/cz7dpelp294o
NYSC for statement today warn say without di NERD clearance, corps members no go eligible for mobilisation for di compulsory one-year service scheme. -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
As e be so, Infantino dey stand for re-election for March as im dey target im fourth and final term as president.
Im go need 106 votes from di 211 Fifa members to win.
www.bbc.com/pidgin/articles/cj36z1yl34do -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Iran statement dey come afta US President Donald Trump announce say new tok-tok on ending di war for Iran go start today - and add say im don call off "massive" strikes on di kontri for dis purpose.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/cqlxznwzr07o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Civicus tok say di Watchlist highlight kontris wia serious decrease dey in freedoms of expression, association and peaceful assembly.
Burkina Faso military govment neva respond to Civicus report.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cvg8dwv92glo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Even though say security forces dey sometimes succeed chase di attackers comot, di way bandits dey change tactics dey increase fear and dey make di work of security agencies harder
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/cd7lr3yr7wjo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Lawyers to Adeniyi Adeyemi, di man wey govment dey accuse say e fake one federal agency called Presidential Foreign Investment Promotion Council, don point accusing fingers at oda govment agencies wey dem claim say also dey complicit for di scandal.
www.bbc.com/pidgin/articles/cy8e56yw2dxo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
US President Donald Trump don tok say new tok-tok wit Iran go start on Monday, afta e bin call off wetin e tok say suppose be "massive" strikes for di kontri.
Global oil price fall for Monday morning during Asia trading afta Trump announcement.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/cqlxznwzr07o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
South Africa police say dem don arrest dozens of illegal immigrants wey dem go deport according to law.
Di police also say dem arrest three employers wey also allegedly employ undocumented foreign nationals.
Read full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c78gz09n3wpo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
On Monday, Kano State Police Command tok say dem arrest one 25-year-old woman wey dem allege say she cut off her boyfriend penis while e dey sleep inside one hotel room wey dem lodge for Kano.
But dem go fit join di gbola back or di guy do go?
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/cvg7n90v9z3o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
For 19 January, President John Mahama bin select eight pipo to sit on top one committee wey go review di kontris constitution.
Di committee involve civil society reps, former Supreme Court Judge and oda lawyers and governance pipo.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/cx27xrle0g3o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Dis na di first time President Bola Tinubu go publicly address how govment take secure di release of di school children and teachers wey jaguda pipo kidnap for di state.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/cddj39dq8zdo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Dis na part of di second phase of one US-brokered Gaza ceasefire plan wey include di disarmament of Hamas, di withdrawal of Israeli troops plus di reconstruction of Gaza.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/cdj02g02l93o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Tyla bin drop di dates for her A*Pop album world tour on Monday as part of di promotion for di album, A*Pop wey drop on 24 July and as part of am include three dates for Africa.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cvg7w310w9xo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Fifa give all 211 member associations until 19 September to decide weda dem agree wit di plan.
Read full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cp3rkplly04o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Dis go be di first headline concert wey Tyla dey run for di kontri even though she bin visit during Detty December for 2024 dey chill wit Rema, Ayra Starr and Tems.
www.bbc.com/pidgin/articles/cvg7w310w9xo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
For one investigative hearing for di House of Representatives on Wednesday, Madam Walson-Jack admit say her office no try as dem fail to do di necessary background checks bifor giving critical approvals to di 'fake agency'.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/c62xdvvl7dpo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Lawyers for Sedina Tamakloe bin argue for court say di charges bin dey "fundamentally defective wey di prosecution bin fail to establish di offenses beyond reasonable doubt."
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/ckg6d330l01o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Centcom say dem hit "dozens" of Islamic Revolutionary Guard Corps (IRGC) targets in response to Iran firing on US bases for Jordan and for ships for di Strait of Hormuz.
www.bbc.com/pidgin/articles/c235gr3llzdo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
House hunting don show you shege bifor?
We carry some Nigerians enta studio for our TikTok live show 'Make We Yarn' to tok dia experience.
Some agents go demand for married couple, agent fee and even high rent fee.
Wetin be your experience wit house hunting and agents?This media couldn't be displayed. See it on the original post. -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di South African Weather Service (SAWS) say veri cold and wet conditions wit light snowfall dey expected to set in from Wednesday evening for several across di kontri.
But wia go dey affected?
Read full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cn0nz10z333o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Nigeria President Bola Tinubu say e inherit challenges from im predecessor, but im no run away.
E say any opponent wey wan collect di govment from am go try.
Tinubu tok say if im political opponents dey cry, maybe na sake of fear.
#tinubu #2027election #nigerianelection -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Nineteen pipo dey miss for Aeon shopping centre and paper factory afta 6.8 magnitude earthquake hit Japan, according to official.
Read full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c86n1y7pg6eo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
On di steps South Africa dey take to handle di issue of migration, Ramaphosa say im govment first don take certain position against any form of intimidation, vigilantism or violence on foreign nationals.
www.bbc.com/pidgin/articles/cjrvn5q5lpno -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Security analyst Adib Saani say di US position for dis mata no really clear sake of dem neva dey part of di ICC bifor.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/c4g38nn04ydo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Afta dem claim a record-extending 10th title for di North African kingdom last July - a campaign dem bin tag "Mission X" - di Super Falcons remain di focus for African women's football.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/clyv3q98v5po -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Gunmen attack community for Kaduna State, killing about 30 pipo including children.
One family lose about five children for di attack.
Di attack happun around 12 midnight as pipo start to dey hear gunshots anyhow.
Dis no be di first time.
Read tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cre4qe21qexo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di 2026 Women Africa Cup of Nations don start ooo.
Di tournament wey officially open on Sunday 26 July, 2026 start wit ogbonge action afta host kontri Morocco sama Kenya 4-0.
Nigeria dey chase 11th title.
Who go win dis year Wafcon?
Read full: www.bbc.com/pidgin/articles/cedjyd5p9wvo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Chad under military ruler of Chad Mahamat Déby don announce dia decision to withdraw from di International Criminal Court (ICC).
Dis dey come months afta Burkina Faso, Mali and Niger also withdraw from di ICC.
But why Chad take dis decision?
www.bbc.com/pidgin/articles/c4g38nn04ydo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
All dis dey happun as plenti Africans don dey try to comot dia citizens from di kontri following deadline of 30 June wey di protesters against immigration give immigrants for di kontri.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/c151v8z813no -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di 9.6 feet giant wey bin suffer one medical condition wey dem call 'gigantism' die on Monday 27 July for hospital, according to im family.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/c4gkrnd52yzo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di building wey collapse na Elite lodge for Oko poly, Anambra state.
Eye witness for di area say dem hear loud noise before di collapse happen. Dem say dem hear cry of pipo wey dey cry for help from di rubbles.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cly9wd17ll4o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
One Nigerian national, Ibeh Chika Simon don kpai for South African police hand for one South African Police Service Operation wey happun for 23 July for Cape Town.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/c151v8z813no -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Anthony Joshua don beat Kristian Prenga.
Dis na afta e recover from attempt to knock am down inside 20 seconds to secure a second-round knockout of Kristian Prenga for one ogbonge clash for Jeddah.
Dis na im first fight afta e survice car crash for Nigeria last December.. -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Dem go implement di new force structure for two phases.
Di second phase, wey involve establishment of di 83 Division and further reorganisation, scheduled to finish by December 2026.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/c0ejgw8e0qjo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
President Cyril Ramaphosa bin approach di court to stop di impeachment process pending im application to review di Section 89 Independent Panel report.
Di mata relate to di stealing wey happun for im Phala Phala farm.
www.bbc.com/pidgin/articles/c8jn0y1m70xo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Experienced Nigeria Super Falcons midfielder, Ngozi Sonia Okobi-Oke Ngozi Okobi tok to BBC about her return to di national team afta her maternity break to born her pikin.
#bbcnewspidgin #wafcon2026 #superfalcons #motherhood #marriageThis media couldn't be displayed. See it on the original post. -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Motsepe tok say di increase show Caf plan to further grow di tournament, afta dem already change di competition from evri two years to evri four years.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/c4gv3427d32o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
US President Trump don hail Nigeria PresidenTinubu "decisive leadership" and tok say na "true honour to stand wit you for di fight against terrorists".
But how well di military don do since Donals Trump begin support Nigeria for dia war against terror?
www.bbc.com/pidgin/articles/cg7mznmey57o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Ghana president tok say South Africa president bin send one team to Ghana to discuss di situation.
But according to Reuters, one tok-tok pesin for South Africa foreign ministry say di petition dey opportunistic.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/cd0xj48ev8vo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
South Africa tell companies and oda employers for di kontri to employ mostly dia citizens and permanent under one new scheme.
Di Home Affairs gazette di launch of di scheme to modernise South Africa immigration
Wetin be dis scheme wey dem launch?
www.bbc.com/pidgin/articles/cp87ql5145eo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Nigerian Army say dem don kill Abu Salim al-Barnawi, di 'notorious' Boko Haram/ISWAP raid commander.
Di Army say Abu later bicom chief photographer and propaganda operative for di terrorist group.
Read full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cq89k2n7e8yo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
'Tiktok no dey safe again', one user post on top social media afta one Ghana court jail tiktoker Camila Alhassan.
Wein be di issue. Abuse or misuse of press freedom abi na just oppression.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/ckg47wydxewo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Nigeria House of Representatives don pass motion to investigate di xenophobic attacks against Nigerians for South Africa, make dem fit document all di economic and material losses wey Nigerians suffer for South Africa.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cpvwn91zryjo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
ICPC tok say dem don seize about 942 million naira ($683 thousand) wey dem allege say connect to fraudulent salary payment to fake workers.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/cx27nw82zlyo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di new UK Prime Minister Andy Burnham no waste time at all to appoint pipo into im cabinet.
Tori be say by dis afternoon, di PM go gold im first cabinet meeting.
But who be di pipo wey im don appoint so far? www.bbc.com/pidgin/articles/c8dnq6934vpo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
No be tori again say na 14 pipo die for di boat accident wey happun for Jigawa yesterday. Dem still dey look for many odas for from di boat wey carry 40 passengers
Dis no be di first time dis kain accident dey happun. Wetin dey cause am and how e fit stop?www.bbc.com/pidgin/articles/c75gw3xd33vo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Chidinma Adetshina dey challenge di Department of Home Affairs deportation order wey make dem drag her go court.
South Africa authorities bin arrest her for June ontop allegation say she enta di kontri illegally.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c1j1rywzyj8o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Afta di trial, di High Court say Wontumi bin unlawfully assign mineral rights without di approval of di sector minister.
Dem also find am guilty say im facilitate mining activities without authorisation, contrary to di kontris Minerals and Mining Act.
www.bbc.com/pidgin/articles/c79gz0z3v72o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Starmer officially submit im resignation letter give King Charles III to mark di end of im tenure as UK Prime Minister.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/cx2k7wp40e1o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Dis World Cup set historic all-time tournament attendance record wit ova 6.8 million fans wey visit all di 16 stadiums for US, Mexico and Canada; average of more than 65,000 spectators per match.
Apart from this one, many odas dey.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/cwym9m1n9jno -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
"South Africa suppose dey reminded say di freedom wey dem dey currently enjoy na di result of di sacrifices and liberation efforts of African kontris, including Nigeria," President Tinubu tok for Ecowas meeting.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/cq6dl1gjgvzo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Home Affairs for South Africa say although dem born Chidimma Adetshina for Soweto, her parents no be South African citizens or permanent residents dat time, dis mean say she no automatically qualify for citizenship.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c1j1rywzyj8o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Almost one month afta dem swear am in as Member of Parliament, Andy Burnham go become di new Prime Minister of di United Kingdom on today.
Dis na afta Kier Starmer resignation lead to one leadership race wey later turn to one-candidate race
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/cx2k7wp40e1o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Spain fans celebrate afta di kontri win dia second ever World Cup, as dem beat defending champions Argentina 1-0 afta extra time.
Spain na also di first kontri wey go be men and women World Cup winners at di same time.
www.bbc.com/pidgin/articles/cly52j28kp8o
#fıfaworldcup #spain #argentinaThis media couldn't be displayed. See it on the original post. -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Spain na di World Cup winner.
Di Spanish beat Lionel Messi side Argentina to lift di trophy for di second time.
Goal by Ferran Torres for di extra time help di Spanish side to win di 2026 Fifa World Cup.
#worldcup #worldcupfinal
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/cly52j28kp8o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Stars Lionel Messi and Lamine Yamal go clash for di biggest match of di biggest World Cup in history
www.bbc.com/pidgin/articles/cly52j28kp8o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
For anoda separate counts, di first defendant chop accuse say na im provide training and instructions to terrorists and im dey ginger members to commit acts of terrorism through one WhatsApp group titled "The Oneness of Allah is the Foundation of Peace.”
www.bbc.com/pidgin/articles/cdx79qz92kxo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
For dia unanimous decision, di Appeal court rule say subsidiary law no go fit disqualify any individual wey di constitution don already qualify.
Na Justice Balkisu Bello Aliyu lead di panel and Justice Eberechi Nyesom-Wike read di lead judgement.
www.bbc.com/pidgin/articles/c89nl7ej3z5o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Mary Habila papa and oda family members don carry dia complain go Abuja afta dem no fit get dia daughter deadi body for Ebonyi.
Di papa say dem no dey suspect anybody. Dem just wan bury dia pikin.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/cddj7gpj6e8o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
One female TikToker for Ghana don chop one year imprisonment afta she plead guilty to publishing 'abusive and offensive content' against di kontri president and first lady ontop social media.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cvgj3514604o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Na at least 20 schoolchildren and one adult die inside one road accident wey happun for Uganda.
According to officials, di accident happun to bus wey bin dey carry pupils for study trip.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c0qvzen0p0vo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Trump administration don give final notice of plans to implement stricter rules on foreign students, wey include to stop dem from staying for US for more dan four years unless dem get permission from di federal govment.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c89nw9jqpzjo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di charges wey dem dey try her for neva dey clear but tori from South Africa say she dey face deportation charges afta allegation say she enta di kontri illegally.
www.bbc.com/pidgin/articles/cjwx3y29984o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di minister Dave Umahi for briefing wit tori pipo for Abuja on Thursday say evidence boku about how Ms. Mary die.
Oga Umahi tok say Mary boyfriend don also reveal wetin e discuss wit di woman before she die.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cddj7gpj6e8o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di US House of Representatives don agree to one amendment bill wey go increase withholding of assistance to Nigeria from 50 percent to 100 percent until di West African nation take effective steps to prevent and respond to violence within dia territory.
www.bbc.com/pidgin/articles/c62e49qdp82o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Nigeria regulatory agency in-charge of company regulation, Corporate Affairs Commission (CAC) don list 100,000 companies wey dem go comot dia names from dia register.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c141z7mg37yo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
United States don identify 23 kontris across Africa, Asia and Europe wey dem consider too dangerous for American citizens to visit.
Full list of kontris US Department of State warn dia citizens say make dem no travel to: www.bbc.com/pidgin/articles/c5ywdjxvej4o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Govment officials say di death of Bashiru Isak dey linked to di current wave of xenophobic attacks for South Africa even though police for di rainbow kontri say di death dey related to 'extortion".
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c4gjdl3g9e8o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Tori be say di girl do video wia she tok wetin allegedly happun between she and di content creator Odogwu Asaba.
Though police say dem don arrest di content creator, wetin go happun next neva clear.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/c86nll7j720o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Earlier dis month, dem shoot March and March Gauteng leader Andile Mvuyelwa Somgxada for outside im home on 4 July, few days afta di June 30 protests.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c6212j6rn0go -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
During one raid for Islamabad, di capital, for di end of last month, officials discover 500kg of wetin dem believe to be human placenta for one illegal processing facility.
Wetin dem dey use am do?
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/c39y9mveewyo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Ova 300 Nigerians don arrive from South Africa sake of di protests against undocumented migrants.
Nigerian govment bin start di repatriation exercise to evacuate dia nationals wey wan comot for SA sake of di anti-immigration wahala for di kontri.
www.bbc.com/pidgin/articles/c4gyg2n3dzpo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di outcome of di match between Argentina and England today go determine who go face Spain for di World Cup final.
Di reigning champions go fit play for back-to-back final for di World Cup or England go dash dia hope.
Wetin be your prediction?
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cg5359yj56lo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Dis dey follow earlier evacuation of nearly 1,000 pipo from di rainbow kontri for early June, due to xenophobic attacks and harassment against African nationals.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cy494k18rkeo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Nigerian govment bin start di repatriation exercise to evacuate dia nationals wey wan comot for South Africa sake of di anti-immigration wahala for di kontri.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c4gyg2n3dzpo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Tori be say na for Osun state, Southwest Nigeria police arrest Prince Adeyemi.
Video wey don go viral show how police dey ask am kwesion afta di arrest wey happun just as Judge issue di order for Abuja today.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c9d2dev4724o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di papa of di military officer wey die during di rescue operation of di Oyo kidnapped children and teachers say di death of im son still dey shock di family.
Full tori: bbc.com/pidgin/articles/crr8rzr2x2po -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Though Prince Adeniyi Adeyemi no dey for court, police still knack am wit eight charges.
Justice Umar Mohammed of di Federal High Court in Abuja say police must carry am come court to ansa for di fake agency mata.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/c9d2dev4724o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Air Peace aircraft wey go fly 315 returnees dey expected to depart South Africa by 1:30am and land Murtala Mohammed International Airport, Lagos by 6:30am, tok-tok pesin for di foriegn affairs ministry tok.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/c4gyg2n3dzpo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
France go jam Spain for di first semifinal clash for dis World Cup.
France bin dey rank number one for di Fifa world ranking and Spain dey third for di world.
Wetin be your prediction?
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cz9l95e70pzo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Many believe say na reprisal attack happun on Sunday afta di death of Alhaji Ardo Risku Muhammad, di Benue State Chairman of the Miyetti Allah Cattle Breeders Association of Nigeria, wey gunmen attack and kill for Otukpo LGA in June.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/c5yz1exjq4zo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Appeal court judgement na split decision of two to one.
And tori be say di state congresses wey ADC do don get k-leg.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/clye4x7k81go -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
UK Home Secretary, Shabana Mahmood announce say Iran Islamic Revolutionary Guard Corps (IRGC) go dey officially recognised as threat to national security.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/ckg5kv7xrvlo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di political party wey dey face different electoral kasala as one of di main opposition parties for Nigeria, make am clear say "Inec no dey issue nomination portal access or nomination codes to any leadership wey no dey recognised.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/clye4x7k81go -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Denis ‘Miracles’ Aboagye wey be 41-year-old politician and former presidential staffer under di ex-president Nana Akufo-Addo be one of di loud opposition voices wey dey criticise di current govment and dia policies.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/cly7e7e3dw3o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
One parent tell BBC News Pidgin say dem no happy as dia children still dey captivity, and appeal to Nigerian authorities for quick intervention to secure di release of dia own children too.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c2ly52dw5w1o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di World Cup continue to dey deliver drama and unforgettable moments, and di field don come down now to just four nations as di competition enta into di semi-finals.
So wetin we suppose look forward to for di last-four matches? E dey inside dis tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cwy09v0w8r4o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Nigerian military narrate how dem rescue 40 pupils and teachers wey terrorists kidnap from Oriire Local Government Area of Oyo State for 15 May 2026.
Dem say na through inter-agency collaboration dem locate di victims and rescue dem.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/crr8ydep2d9o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Federal Ministry of Education say dem dey suspend di increment sake of concerns and constructive feedback from members of di public.
Dem say dem appreciate Nigerians interest in ensuring access to quality education.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c621pkjlyvvo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Normally, inside Inec timetable for 2027 elections, na from 27 June 2026 reach 11 July, 2026 be di timeline for di submission of presidential and National Assembly candidate lists.
But now, e don extend go 14 July, 2026. Why Inec extend di deadline?
www.bbc.com/pidgin/articles/c5yz144q3v7o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
South African national team midfielder and Mamelodi Sundowns player Jayden Adams don die at di age of 25.
Di Bafana Bafana midfielder make three appearances for di 2026 World Cup tournament.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/c862zv6y4yzo
#jaydenadams #bafanabafana #southafrica -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
President Bola Tinubu don assure di children and teachers wey terrorists kidnap for Oyo state, southwest Nigeria, plus di family of di teacher wey dem murder for captivity, Michael Oyedokun, say im govment go get justice for dem.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cn4r9x2rl92o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
South Africa Zulu king don express "deep" regret afta one leaked video show as e dey sama im third wife wit big-big insults.
For di video wey don go viral for SA, King Misuzulu bin threaten to physically assault im wife as e accuse her of cheating.
www.bbc.com/pidgin/articles/crm0yz1gp10o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Nigeria federal govment say dem don rescue all di pupils and teachers wey gunmen kidnap for Oyo State, southwest Nigeria.
Na President Bola Tinubu tok-tok pesin Bayo Onanuga make dis informate ontop im X page on Friday, 10 July.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cn4r9x2rl92o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Nina Blom mama bin lie for years say she dey sick sotey she put di pikin for wheelchair until one doctor detect say notin do di pikin.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cewq9veny94o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Witnesses tell local media say di head of di man down to di shoulders, bin hang for air for several minutes, bifor oda passengers on di flight manage to pull am back inside di plane.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cvgqxegd08go -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Rivers State Govnor Siminalayi Fubara don present ₦1.854 trillion 2026 budget proposal to di Rivers State House of Assembly.
Here na key tins wey happun bifor di budget presentation: www.bbc.com/pidgin/articles/c30ye3m69dpo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di arms wey dem destroy include pistols, locally manufactured AK47 rifles, shotguns and odas wey pipo bin surrender to di kontri gun amnesty project and odas wey security agencies bin seize.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c2kywkjvpzeo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di arms wey dem destroy include pistols, locally manufactured AK47 rifles, shotguns and odas wey pipo bin surrender to di kontri gun amnesty project and odas wey security agencies bin seize.
www.bbc.com/pidgin/articles/c2kywkjvpzeo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di protest for South Africa enta anoda level yesterday.
Tori be say some groups of anti-immigration South Africans bin seize foreigners from dia houses for Johannesburg escort dem go police station, make dem from dia comot dia kontri.
www.bbc.com/pidgin/articles/c15y8exwgddo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
E no get any one database wey dey collate di monetary benefits for military personnel for Africa. In many kontris, dat information no dey publicly available.
Di full tori dey hia: www.bbc.com/pidgin/articles/cwyezrrrke3o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
As many as 10 players get between three and eight goals.
Kylian Mbappe don join Lionel Messi for eight goals for dis summer World Cup, while Erling Haaland and Harry Kane dey chase dem from behind.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/c33yyleex0po -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
International Criminal Police Organization (Interpol) on Thursday say dem arrest more dan 5,800 suspects, recova more dan $293 million and identify more dan 142,000 victims, inside one major crackdown against criminals across 97 kontris.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c1myvx0g02eo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Huge crowds don gada for di streets of di holy city of Mashhad for di burial of Iran late supreme leader, Ayatollah Ali Khamenei.
Dem go lay Khamenei to rest for di shrine of Imam Reza, Iran holiest Shia Muslim site.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c992d7597l3o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) don arraign di national president of Miyetti Allah Kautal Hore Association, Bello Bodejo, for di Federal High Court Abuja, sake of alleged wuruwuru wey pass 2.3 million dollars.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cn8kmvxldp0o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Bonnie Tyler dey known to millions as di gravel-voiced singer behind '80s hit Total Eclipse of the Heart.
Full tori www.bbc.com/pidgin/articles/c0my34xk7d0o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
According to di US attorney office, Abu Trica be part of one criminal network wey target elderly victims through romance scams and defraud dia victims of up to $8m since 2023.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/ce8je78g0jpo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di quarterfinals get one African team, six European teams and one team from South America.
Dis eight teams go battle for dia place for di semifinal but which of dem go make am?
Full preview: www.bbc.com/pidgin/articles/c9q2ryw8pl1o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Nigeria Civil Aviation Authority (NCAA) na dem dey regulate evritin about di Nigeria airspace, and dis also include Unmanned Aerial Vehicles (UAV) or Remotely Piloted Aircrafts (RPAs), wey pipo just know as drones.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/cpd3049yp23o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Plenty pipo bin expect say dem go beat Cape Verde and Egypt easily for di first two knockout matches, but Argentina struggle well bifor dem win both games 3-2.
Egypt accuse di referees say dem favour Argentina, especially to dia star player, Lionel Messi.
www.bbc.com/pidgin/articles/c4gyveke0qlo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Good morning, correct pipo.
Today proverb na from Wise Words.
No forget to share your own for comment. -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di papa of Adeyemi Adeniyi, di Director-General of di alleged fake federal govment agency, Presidential Foreign Intervention Promotion Council, don cry out say e no know why police break into im house afta di allegations against im son.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c4gy35k43jeo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
US medical drama The Pitt and comedy Hacks lead di nominations for dis year Emmy Awards, America TV honours wey pipo dey always desire.
The Pitt get 25 nominations in total, closely followed by di final season of Hacks wit 24.
See full nominees: www.bbc.com/pidgin/articles/c05yq5p5ee4o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Donald Trump don threaten to attack Iran "hard" tonight, hours afta e tok say di US-Iran ceasefire don end.
Trump wey dey Nato summit for Turkey earlier tok about di Iranian leadership.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cg53lp5mg6zo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Round of 16 for di 2026 Fifa World Cup don end as players and coaches go begin strategise and plan for di quarter-finals wey go start tomorrow Thursday.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c9q2lx5ye1ro -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Motions passed by di legislative arm of govment no dey binding on di executive, but e represent dia strong opinion as di elected representatives of dia constituencies.
Di Senators say dem go send dia decision to president Tinubu.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cdxd7dw4kvno -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Ghana tourism authority add say "her untimely departure be painful loss to di tourism and creative ecosystem and di kontri. Ghana don lose one of her brightest ambassadors."
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/c5yzdznpzz3o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Iran parliamentary speaker Ghalibaf tok say na US breach di so-called MoU, say dem "violate Iranian adjustments for di Strait".
Na last month, Tehnran and Washington bin sign one 14-page MoU, wey bin dey to increase di ceasefire and end di kasala.
www.bbc.com/pidgin/articles/cg53lp5mg6zo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
As many pipo expect, Argentina don qualify for di Round of 16 for di sixth straight World Cup. But e no easy for dem as many pipo bin tink.
How dia match wit Egypt go be?
www.bbc.com/pidgin/articles/cx235p04kweo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Several pipo dey injured afta explosion wey happun for central Damascus, reportedly near di hotel wia French President Emmanuel Macron dey stay.
One security source tell di BBC say na explosive devices cause di blast.
www.bbc.com/pidgin/articles/cdejw9p33deo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di protesters bin give migrants till di end of June but evacuation process still dey go on.
Di first batch of 258 pipo bin arrive Nigeria on 11 June, while on 24 June, di second batch of 66 pipo arrive, and den on 30 June di third batch of 269 pipo arrive
www.bbc.com/pidgin/articles/cj0g32mnyjvo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di 2026 Fifa World Cup dey kontinu to bring shocks and surprises as di Round of 16 wey start on Monday go end on Tuesday.
Two ogbonge matches Argentina vs Egypt, Switzerland vs Colombia go happun today wey go complete di last eight.
www.bbc.com/pidgin/articles/c9q2lx5ye1ro -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Four days afta she do liquid BBL for one Essex clinic in October 2023, dem rush 28-year-old Louise Moller from Bolton go hospital wit sepsis.
She call her mama, Janet Taylor, from A&E: "Mum, I think I go die," she tok.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/cvgmmrmj88do -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Mali army say dem kill several armed militants wey attack dia military positions for some parts of di kontri ova di weekend.
For dia statement, di army say di situation dey under control for five cities wey di militants target.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cly77p8m4gmo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di victims of dis fresh attacks na Emeka Iroegbu and Musa Joe, wey happun few hours to di deadline wey anti-migrant organisations give undocumented foreigners to comot di kontri.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c8622l2p9elo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
United Bank of Africa Chairman Tony Elumelu don disclose say im 12-year tenure go expire on 12 August and Emmanuel N. Nnorom go replace am.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c0myyy031pmo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
BBC US media partner CBS News confam say Balogun reinstatement happun afta US President Donald Trump call Fifa President Gianni Infantino on Thursday to discuss di suspension.
Uefa don express dia shock ova di decision.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cm2jjrj9ryro -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
As many as 10 players get between three and seven goals.
Lionel Messi of Argentina, Kylian Mbappe of France and Erling Haaland of Norway all get seven goals.
Dis be di first time three players score seven goals for any Fifa World Cup.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c33yyleex0po -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Inside di IMF reports, di international financial institution warn Nigeria govment say di economic reforms wey dem dey do no show improved living condition among Nigerians and dis fit cause outbreak of violence for di kontri.
Read di full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/ckg77kjrdveo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di latest pesin wey announce say e don comot from Triple R Kannywood for Renewed Hope na popular actor Rabiu Rikadawa.
E tok say e leave di group bicos of wetin e call "lack of transparency and failure to follow di rules of di group."
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/c79yy5x44yvo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di 2026 Fifa World Cup don enta advanced stage and for some ogbonge players, dis go be dia last tournament; odas go try one more time for di 2030 World Cup.
Who be diz players wey dey retire from international football afta di World Cup?
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/cjwgg1j5zzpo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Ozonna never come out to explain why e do di video abi why e call out di Nigeria politicians, but di young man dey popular for post dance videos on im personal social media handles.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/clyrr9qll01o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Iranian officials bin plan to run dis burial for March but dem gatz postpone am sake of di war.
Dem kill Khamenei for im compound for Tehran during di first wave of strikes wey US and Israel bin sama Iran.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/crlww3ze414o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di case bin start for 2018 wen ISI ban female Muslim students make dem no dey wear headscarf wit dia uniform.
Eleven students, wit support from Muslim Rights Concern, sue di school and di University of Ibadan for Oyo State High Court.
www.bbc.com/pidgin/articles/cq61prnvq29o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Black Stars of Ghana go try to become one of di few kontris to qualify but dem gatz jam wit South American team Colombia.
We go do live updates of dis match: www.bbc.com/pidgin/articles/cdjk71vngpko -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Dis latest withdrawal from di ICC na anoda concern to human rights groups ontop how justice go happun for dis kontris.
So, how dis three kontris go dey prosecute war crimes, crimes against humanity and genocide committed during dia conflicts.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/c4gydz2nzr7o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di United States don withdraw most of di sojas wey dem send come Nigeria for one joint operation to fight terrorism for di Lake Chad basin.
Wetin e mean for Nigeria? E dey inside dis tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cly76je7lnlo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Anoda batch of 266 more Nigerians don touchdown di Murtala Muhammed Airport, Lagos dis Friday morning from South Africa, as di Nigerian govment continue to evacuate dia citizens sake of anti-immigration protests wey dey go on for di kontri.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cj3g7djj4p4o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Anoda batch 271 Nigerians go touchdown di Murtala Muhammed Airport, Lagos dis Friday morning from South Africa, as di Nigerian govment continue to evacuate dia citizens sake of anti-immigration protests wey dey go on for di kontri.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cj3g7djj4p4o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Anoda batch 271 Nigerians go touchdown di Murtala Muhammed Airport, Lagos dis Friday morning from South Africa, as di Nigerian govment continue to evacuate dia citizens sake of anti-immigration protests wey dey go on for di kontri.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cj3g7djj4p4o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Independent National Electoral Commission don get six chairmen since Nigeria return to democracy for 1999.
We examine di different challenges wey each Inec chairman face during dia time as head of di commission.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/ce3eg7nr056o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Out of di 10 most populated countries for di world, only two don make am to di current tournament (di United States and Brazil).
Two odas (Russia and Nigeria) don appear for plenty previous editions.
But wetin dey happun gan-gan: www.bbc.com/pidgin/articles/cly87n87qj2o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Presidency of di Assembly of States Parties to di Rome Statute, respond to di steps wey di govments of Burkina Faso, Mali, and Niger take for dia withdrawal from di Rome Statute.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/c4gydz2nzr7o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Presidential tok-tok pesin Bayo Onanuga accuse Adeniyi Adeyemi say e use fake documents wit forged signatures and seals, to dey claim leadership appointment for office wey no dey exist.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c621lxlp5gyo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di pilot wey crash im small plane into Beijing tallest skyscraper last week dey suffer from "chronic insomnia and anxiety" and e do am for "personal reasons", authorities tok on Thursday.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/crel1q21zzgo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Pipo for Ethiopia town of Hossana don kpai at least 400 dogs afta series of deadly dog bites mount di area.
Di residents and officials of Hossana town say di killings bin start afta three children kpai from rabies-related complications.
www.bbc.com/pidgin/articles/cy491vkeewdo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Controversy don choke for di Nigeria Presidency as di office of di Chief of Staff to di President as well as di main tok-tok pesin for di President, Bayo Onanuga, don disown one Prince Adeniyi Adeyemi wey claim to be appointee of di President.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c621lxlp5gyo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Pipo for Ethiopia town of Hossana don kpai at least 400 dogs afta series of deadly dog bites mount di area.
www.bbc.com/pidgin/articles/cy491vkeewdo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
South Africa police dey refute reports say one Ghanaian die during di 30 June anti-immigration protests, afta Ghanaian authorities condemn di killing of 40-year-old citizen for Cape Town.
Ghana govment say di killing happun during di protests on Tuesday.
www.bbc.com/pidgin/articles/c6215455g9lo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Inside one statement, di foreign affairs ministry confam say dem identify di deceased as 40-year-old Bashiru Isak, wey di shooting happun for Khayelitsha for Cape Town.
Authorites for South Africa neva comment on di killing.
www.bbc.com/pidgin/articles/c6215455g9lo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Na Youri Tielemans score di winning penalty for Belgium wey bury Senegal.
Football just dey crazy. E dey hard to believe say Senegal go lose wit just 10mins to di end of di game.
Senegal go blame dem sef for dis loss: www.bbc.com/pidgin/articles/cg4wgwl7kqgo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
How Senegal take allow Belgium equalize dia teo-goal lead.
Dem go fit survive dis extra time?
Live updates: www.bbc.com/pidgin/articles/cg4wgwl7kqgo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Belgium look very ordinary. Dem look tired and dem gatz ginger well fo dis second half.
If not, Senegal go knack dem comot.
Live updates: www.bbc.com/pidgin/articles/cg4wgwl7kqgo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
DR Congo troway dia early lead and lose 2-1 to England for di Round of 32 of di 2026 Fifa World Cup.
England go now meet Mexico, one of di co-hosts for di Round of 16.
www.bbc.com/pidgin/articles/cx26434deylo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Hary Kane again.
Dis goal fit be one of di best goals for di World Cup. DR Congo still fit do something?
Live updates: www.bbc.com/pidgin/articles/cx26434deylo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Dis changes dey happun afta di Democratic Alliance (DA) demand make di president make some adjustments to di members for Government of National Unity (GNU).
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/c36y3lxg600o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
GOOAAALL!!!
Harry Kane equalize for England. No be small tin.
Live updates: www.bbc.com/pidgin/articles/cx26434deylo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
For statement wey di highest bank for Nigeria release today, CBN tok say dem revoke di license "in accordance wit dia powers under Sections 12 and 13 of di Banks and Other Financial Institutions Act (BOFIA), 2020."
But wetin di banks do?
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/cvgmvy55ge6o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Fifa World Cup don enta di business stage as kontris don begin qualify for di Round of 16 wey start on Monday
For dis round, kontris wey qualify for di Round of 32 go play wit each oda, so far many ogbonge kontris for World Football don begin crash out
www.bbc.com/pidgin/articles/c9q2lx5ye1ro -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di leadership of di students don send warning give di Nigerian Army make dem find di officers wey carry out di at and make dem face di law.
www.bbc.com/pidgin/articles/c5yz5z02l0po -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
2021 Afcon champions Senegal dey jam wit Belgium for dia round of 32 game for di World Cup.
Na di first time di two teams go meet, but who go win?
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cg4wgwl7kqgo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
"I be di first pesin for my family wey get dis condition – for di beginning I neva really accept am, my papa also no understand am until di doctor explain give am say make dem accept my new reality,” Abigail Asabea Boateng tok.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cwykx219ng3o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
England go meet stubborn DR Congo side wey don reach di World Cup knockout stage for di first time in dia history afta dem turn into well-organised and disciplined team under coach Sébastien Desabre.
Who go sing di victory song today?
www.bbc.com/pidgin/articles/cx26434deylo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di protest against undocumented migrants for South Africa go continue until di govment introduce tougher laws against illegal migration, Jacinta Ngobese-Zuma, di leader of March and March movement, tok.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cqj19pr74rgo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Inec dey expect list of candidates from different registered political parties wey dey participate for di 2027 general elections.
But wen be deadline for submission and wetin go happun to parties wey get court cases? E dey inside dis tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cm2dr40nz57o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Senegal lawmakers don pass one controversial constitutional reform wey go expand dia power more but e go reduce president power, dis don cause protest for outside di parliament.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/crr8x7pwk87o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Ivorian fans bin dey happy bifor Erling Haaland fire di second goal to break dia heart for di 86th minute.
Ivory Coast hustle for di last minutes but dem no fit score di equalizer
Norway qualify for di Round of 16 for di first time for di Fifa World Cup
www.bbc.com/pidgin/articles/ckg48r8z0z9o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Halaand wit di tap-in.
Ivory Coast get 7mins to decide dia fate for dis World Cup
Live updates: www.bbc.com/pidgin/articles/ckg48r8z0z9o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Sweet goal by Amadou Diallo.
Ivory Coast don push Norway go back. Halaand still dey find half chance to score but e never see am.
Live updates: www.bbc.com/pidgin/articles/ckg48r8z0z9o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Na Ivory Coast bin dey ginger di game pass but na Norway don score.
Di defenders bin think say Nusa wan cross but di Norway winger go for goal.
Live: www.bbc.com/pidgin/articles/ckg48r8z0z9o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Ivory Coast 0-0 Norway
Both Ivory Coast and Norway shine well for di group stage, but one of dis two teams go crash out of di World Cup few hours from now.
Live updates: www.bbc.com/pidgin/articles/ckg48r8z0z9o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
In di end, majority of di nine justices of di Supreme Court no gree reverse di 150-year-old court precedent and reinterpret federal law wey don tey on Trump order wey wan limit birthright citizenship.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/cly9zdv9j8zo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
In di next few months, di company go roll out dis feature to dia more dan three billion account holders over the next few months.
But how dis new WhatsApp privacy feature go work?
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/cj6gdzrn49zo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di third batch of Nigerian citizens wey dey comot from South Africa don land for Murtala Muhammed International Airport, Lagos.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c5yzdvjkzv1o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Ivory Coast and Norway both shine well for di group stage, but one of dis two teams go crash out of di World Cup on Tuesday.
Wetin be your prediction?
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/ckg48r8z0z9o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Floods for Accra don claim lives and properties as pipo still dey count dia losses.
Dis na wetin to do if you find yoursef for dis kain situation: www.bbc.com/pidgin/articles/ckg72041rlpo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
"We send our children go school make dem write exams. We neva tink say dem go carry dem comot from dia classrooms. We pray make God bring dem back to us safely,” one mama tok.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cm2j8y2dm43o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Anti-migrant protests don start for South Africa as di June 30 deadline wey pressure group March and March give undocumented migrants to comot for di kontri take effect today.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c70ynwkw542o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di NYSC go operate under civilian operational leadership, while di military go continue to provide security support.
Di mobilisation process go become technology-driven to improve efficiency, transparency and ease of service.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cze90577rg6o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Dis na di first time she dey tok afta her comment about 'akara', 'kuli-kuli' and 'corn' begin trend.
“I hear say pipo dey tok about women wey dey sell akara...We dey support pipo wey dey sell corn, tomatoes, vegetable and odas,” Remi Tinubu tok today.
www.bbc.com/pidgin/articles/ceqdzd1lnweo
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
-
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Na tomorrow June 30 be di deadline wey protesters give black migrants to comot from South Africans
Nigeria minister of Foreign affairs Bianca Ojukwu say dem dey safeguard dia citizens ahead of di anti-immigrant protests.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c5yzdvjkzv1o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
According to her family, medical scans wey dem do before di operation show say she get two healthy kidneys.
But afta di operation, she come sick seriously, and further medical tests reportedly show say she now get only one kidney.
www.bbc.com/pidgin/articles/cn8q16509vxo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
About 76 former members of Iswap members don drop dia weapons and surrender to Nigeria govment forces for di North East region.
Usually, di next thing wey go happun na to rehabilitate dem. But dis rehabilitation dey work?
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/c1lyzz9j457o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Kenya Revenue Authority (KRA) don issue deadline for all taxpayers to file dia 2025 income tax returns to avoid penalties.
Dem fix June 30 as di deadline for all taxpayers to submit di returns say dem no go extend di deadline.
Dis na how to file am: www.bbc.com/pidgin/articles/c70yljgj3l1o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
South Africa coach Hugo Broos tok say im dey proud of di team wit wetin dem achieve to reach di R32 stage for di competition.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c4gy4n13g66o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Na Tuesday, 30 June anti-immigration protesters give African migrants to comot for South Africa.
South Africa Police Service ready gidigba and don deploy law enforcement officers across di kontri to maintain law and order.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cd95z943le7o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Dis go be di first time for history wen both South Africa and Canada go reach knockout stage for di World Cup.
www.bbc.com/pidgin/articles/c4gy4n13g66o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Burkina Faso don announce di cut of diplomatic relations wit France, dia former colonial masters.
Dem make dis announcement inside one official statement wey dem publish on Friday, 26 June.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cy73v68nrkjo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di number of pipo wey die for Venezuelan earthquakes don jump to at least 920, wit 3,360 injured, according to President of di National Assembly Jorge Rodríguez.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/ce95d08grg2o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di number of pipo wey die for Venezuelan earthquakes don jump to at least 920, wit 3,360 injured, according to President of di National Assembly Jorge Rodríguez.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/ce95d08grg2o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Death toll for di Lagos building collapse wey happun on Thursday, 25 June don rise to nine as di rescue teams recova 27 pipo alive.
Full tori: bbc.com/pidgin/articles/c621057ln5xo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di number of pipo wey die for Venezuelan earthquakes don jump to 589, wit 2,980 injured, acting President Delcy Rodríguez tok.
Full tori: bbc.com/pidgin/articles/ce95d08grg2o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Nigeria Democratic Congress (NDC) say dem dey challenge di Federal High Court ruling wey nullify dia registration as political party.
Full tori: bbc.com/pidgin/articles/c8921j9wpp0o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
One Federal High Court for Lokoja, Kogi State, on Friday set aside im earlier judgment wey bin direct di Independent National Electoral Commission (Inec) to register di Nigeria Democratic Congress (NDC) as political party.
Full toriL www.bbc.com/pidgin/articles/c8921j9wpp0o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
"We dey try to give hope, and to start akara business no cost plenty money. To start roasting corn, or pesin even say kuli kuli no dey take much. We bin no give dem loan; we bin give dem as grant,” di First Lady tok.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cvg4vy43z1po -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
"If di President really wan fight dis (insecurity) tin, why e leave am until di year of election,” one Northern Senator tok.
But one security expert say to create State Police na di right step for di right direction.
Wetin you think? - www.bbc.com/pidgin/articles/cwy0k4vg221o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
One website dem create to track missing pipo wey opposition leaders from the politically divided kontri listed more dan 49,600 pipo wey dem still neva see, while di U.S. Geological Survey predict more dan 10,000 deaths.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/ce95d08grg2o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di 'March and March' movement wey dey lead di anti-immigration protests since April, say any African migrant wey remain for dia kontri afta di 30 June deadline go blame diasef.
www.bbc.com/pidgin/articles/c932x2vpz29o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Some pipo no too give African kontris for di World Cup chance sake of how dem bin start di tournament.
But now some African kontris don qualify and odas wey get chance as best losers from dia groups fit still qualify.
Di World Cup standings dey hia: www.bbc.com/pidgin/articles/ce8k36nj8yjo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Good morning pipo!
Na Iyke Ozioma drop dis proverb for us, wetin e mean?
Abeg drop your own for comment section. -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Back-to-back earthquakes for Venezuela death toll don rise to 188 and more dan 1,500 pipo get different type of injury, according to di lates reports.
Full tori: bbc.com/pidgin/articles/ce95d08grg2o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Death toll for di Lagos building collapse wey happun for Alakija, along di old Ojo Road toward Satellite Town for Lagos State don increase to eight.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c621057ln5xo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Authorities don confam say two pipo don die and several odas injure afta three-storey building collapse for Lagos.
Dis dey come less dan 24 hours afta anoda building collapse claim one life for Port Harcourt, Rivers State.
www.bbc.com/pidgin/articles/c621057ln5xo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Heatwave wey dey hold western Europe don cause plenty record-breaking high temperatures.
France dey experience dia hottest day eva, UK don see record-breaking heat for June, and Spain don reach dia highest daily average temperature since 1950.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c4gyprd2ryro -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di new executive bill to create State Police for Nigeria wey President Tinubu send and wey di Senate pass yesterday, dey almost certain to bicom law even bifor di 2027 general election.
www.bbc.com/pidgin/articles/cgjxd260yddo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Some teams already don qualify for di Round of 32 stage, odas gatz wait for all di group stage games to end bifor dem go sabi dia fate.
Also sabi say some of di teams wey carry third for dia group go qualify for di knowckout stage.
Hia na how e go be: www.bbc.com/pidgin/articles/cn8kv5m04l4o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Despite di heavy security presence, opposition leaders, civil society groups, youth activists and families of victims say dem go go ahead wit memorial processions and candle-lighting ceremonies for Nairobi and oda towns.
www.bbc.com/pidgin/articles/czx5k8lwp0wo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
More dan 1,000 Nigerians don show interest to return home afta anti-immigration protests and attacks wey dey target black foreign nationals spread to several parts of South Africa, according to Nigerian officials.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/ced4686gnx6o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Venezuela bin dey celebrate national holiday, and many pipo bin dey for house wen di quakes happun.
Di kontri dey for di seismically active zone wia two tectonic plates, di Caribbean and di South American dey meet.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/ce95d08grg2o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Na game wey no too produce much as South Africa dey defend and wait to hit dia opponent wit counter-attack.
Thapelo Maseko snatch di unexpected winner for South Africa, as e hit di ball wey beat South Korea goalkeeper.
Fifa World Cup standings: www.bbc.com/pidgin/articles/crr8e9975vxo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Leaders of di anti-migrant movements and some civic society groups wey include di March and March tok say di 30 June deadline for undocumented foreign nationals to leave South Africa no dey change.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cd0m7yn94nno -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Senate don pass constitutional amendments to establish state police for Nigeria.
Di lawmakers pass di bill on Wednesday, 24 June.
Dis dey come almost two weeks afta di Nigeria House of Representatives pass di bill.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cgl318g64z6o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di National Drug Law Enforcement Agency (NDLEA) don bust one multi-billion naira factory for deep inside one forest for Oyo State, southwest Nigeria, wia dem dey produce methamphetamine on large industrial scale.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/clye6ply1n7o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Ova 1,000 pipo don dey infected wit Ebola for DR Congo and e don kill ova 267, and dis particular trait get di highest number of cases for di first month, according to World Health Organisation
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/c78y4x713q1o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
All dis dey happun as Oyo state govment impose 16-hour curfew across 10 local govment areas for di state as dem continue to search for di children and teachers wey dem kidnap for di state.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cly0xzyqpnko -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Tori be say di June 30 protests for South Africa go dey happun evriday untill di month end.
As pipo dey wait for di meeting wit tori pipo,here na provinces wey violence fit happun for di anti-immigration protest.
www.bbc.com/pidgin/articles/cd0m7yn94nno -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
While di constitution of di Federal Republic of Nigeria say national security and issues of national defence na di exclusive authority of di federal govment, President Tinubu believe say State policing go bring security closer to di pipo.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/cgl318g64z6o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Ghana and England no gree for each oda as dem end dia match for goalless draw.
See match highlights for here: www.bbc.com/pidgin/articles/c0ry0wkqg7qo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
More dan one year afta di death of Zambia former President Edgar Lungu, im family don win dia appeal to bury am for South Africa wia e kpai - and dis overturn one high court ruling wey allow di Zambian govment to return im bodi.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cgmdz1k9demo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Nigerians for South Africa don begin fear as deadline wey protesters give dem to leave di kontri don almost reach.
One Nigerian man tell BBC say di protesters say dem must leave bifor June 30 deadline & say dem go begin do house to house search.
bbc.com/pidgin/articles/c9q2nvje20no -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Sir Keir Starmer don bicom di sixth prime minister to resign or wey voters force comot for di last 10 years.
In case anybodi dey doubt, dis no be di normal levels for British politics.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c70y8z2re42o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di first batch of Nigerians wey govment carry comot from South Africa land for Murtala Muhammed International Airport for 11 June, 2026 but since afta di first evacuation, anoda one neva happun.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/c9q2nvje20no -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di first batch of Nigerians wey govment carry comot from South Africa land for Murtala Muhammed International Airport for 11 June, 2026 but since afta di first evacuation, anoda one neva happun.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/c9q2nvje20no -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Black Stars of Ghana dey prepare to jam wit di Three Lions of England for dia second Group L match today.
Both teams win dia first game wey each of dem get three points ahead of dis game.
How today game go be? www.bbc.com/pidgin/articles/c0ry0wkqg7qo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
However, apart from dis cybercrime mata wey land Sowore for prison like dis, e get oda court gbege wey Sowore dey face for court on top several accusations wey im don deny.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cvgm95lddgro -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Wit di second round of group matches wey dey go on, kontris don dey qualify for di round of 32 and players and kontris too don dey break and set new records.
Check di tables and fixtures: www.bbc.com/pidgin/articles/c9q2lx5ye1ro -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di pre-match hype for plenti foreign media na whether England players go shake hands wit Thomas Partey ahead of di game like how players bin dey shake each oda all di time.
www.bbc.com/pidgin/articles/cj6gy60zk8po -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Residents tok say pesin plant improvised explosive device (IED) under one Toyota Sienna wey carry Lagos plate number.
www.bbc.com/pidgin/articles/crlwzl5lpwjo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Twin brothers - Taiwo and Kehinde Oguntoye – marry identical twin sisters Taiwo and Kehinde Adediran for one joyous joint ceremony.
Di wedding happun ova di weekend for Ibadan, di Oyo State capital, southwest Nigeria.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cvgdv1xg9ypo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Ghana education authorities ban di trend wia parents dey dash dia children cars, phones, money bouquets and oda tins for campus wen dem finish senior high school.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cd6enwywj94o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Dem don swear in Andy Burnham as di MP for Makerfield hours afta Keir Starmer resign as leader of di Labour Party.
Burnham don tok say e go stand to replace di prime minister, wit backing from former Health Secretary Wes Streeting.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c07yp5eel2do -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di actor voter details bin spread online some weeks ago afta media aide to one politician post Emeka Ike details for im page.
www.bbc.com/pidgin/articles/c982j079yy1o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
South Africa acting minister of police, Cachalia, tell local media for one event say di police dey prepare to deal wit di planned June 30 demonstration.
Di South Africa minister of police meet wit oda national commissioner as part of dia preparation.
www.bbc.com/pidgin/articles/cly739zz6gyo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Sources tok say di police fire warning shots for air to try stop di attack and restore law and order but w no work..
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/c39ydrxwjzno -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Starmer don resing but im go remain in office until di Labour Party conclude plans to elect a new leader bifor di parliament go return from dia summer recess by September dis year.
www.bbc.com/pidgin/articles/c4gyjj27e71o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Dis na how di top three candidates perform for di Ekiti State govnorship election wey Biodun Oyebanji of di All Progressives Congress win.
See di breakdown of di election results by local govments: www.bbc.com/pidgin/articles/c0my8pdv2k3o
#ekitidecides2026 -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Eloy Room na 37-year-old Miami FC keeper wey produce great and record-equalling performance for Curacao against Ecuador.
E make 15 saves to keep im kontri level and secure goalless draw wey go live long for di memory of di island nation.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c04yd6y3l1qo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Despite say young pipo na dem plenti pass for Nigeria, elders wey don pass 45 years and wey don dey play big role for di govnance of di kontri still dey hold top political positions.
But why old pipo dey dominate Nigerian politics?
Di answer dey here: www.bbc.com/pidgin/articles/cpwe7488w8go -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Wit im re-election as di govnor of Ekiti State, Biodun Oyebanji don break di state succession jinx wia govnors don fail to secure back to back mandates since di creation of di state for 1996.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cy73n4x5kn0o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Ekiti State govnorship don come and go and Biodun Oyebanji don win re-election.
See di results of di state govnorship election: www.bbc.com/pidgin/articles/c14yegnyk2mo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di current Govnor of Ekiti State Biodun Oyebanji don win di re-election on Saturday, 20 June.
Di ova six hours election no too get drama but tori of some violence and protest dey.
Dis na breakdown of di result local govment by local govment: bbc.com/pidgin/articles/c0my8pdv2k3o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Una Good morning!
Tamaraemi G. Ikpi say make you use dis proverb hold your side dis Sunday.
No forget to share your own for we comment section. -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Inec declare di result for Polling Unit 004, Ward 2, Ekiti South-West Local Government Area, wia Bejide come from.
Follow live updates: www.bbc.com/pidgin/live/cvgq91wqn2wt -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Inec begin upload di results at about 4:10pm today afta pipo worry say dem neva start to dey upload di results from polling units on di portal even though voting don end and counting don start for some locations.
Live updates: www.bbc.com/pidgin/live/cvgq91wqn2wt -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Iran Revolutionary Guard Corps Navy say di Strait of Hormuz dey closed to all vessels, sake of di US and Israel ceasefire violations.
Di Navy come cut serious warning to all vessels make dem no near di Strait of Hormuz.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/cn4dl708q8vo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di govnorship candidate of di All Progressives Congress (APC) wey also be di incumbent govnor of di state Biodun Oyebanji don win for im for polling unit for di Ekiti state govnorship election.
Follow live updates: www.bbc.com/pidgin/live/cvgq91wqn2wt -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Sorting and counting don begin for some polling units for di Ekiti State govnorship election.
Stay ontop di live updates: www.bbc.com/pidgin/articles/c14yegnyk2mo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Govnor Biodun Oyebanji of Ekiti don assure di pipo of di state say di election dey go on smoothly.
E make di assurance afta e cast im vote for PU 003, RA 06 Ekiti West.
Follow live updates for here: www.bbc.com/pidgin/live/cvgq91wqn2wt
#ekitidecides2026 -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di US govment say dem go stop to fund programmes for South Africa wey intend to tackle di spread of HIV and Aids.
More dan eight million South Africans dey live wit HIV - di highest number of any kontri for di world.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/czdevn61p3ro -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Oluwole Oluyede, PDP govnorship candidate for di ongoing Ekiti poll, don allege say police officers dey harass members of im political party, block voters from accessing dia polling units for di community.
Follow live updates: www.bbc.com/pidgin/live/cvgq91wqn2wt
#ekitidecides2026 -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di pipo of Ekiti State don begin vote for dia next govnor as di tenure of Govnor Biodun Oyebanji go expire for 15, October 2026.
See live coverage for here: www.bbc.com/pidgin/live/cvgq91wqn2wt
#ekitidecides2026 -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Ekiti State govnorship election don start, and we dey on ground to bring you live updates as e dey go.
Total of 14 candidates including di current Govnor Biodun Oyebanji dey contest for di number one seat.
www.bbc.com/pidgin/live/cvgq91wqn2wt -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Even though official judiciary news agency neva publish di ruling, groups say di pattern of arrests and legal cases against artists wey dey publicly go against di regime now na wider effort to stop cultural opposition.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c98290qgzvyo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
As Pesin wey dem once see as one of Africa most prominent political figures, Diezani say di accusations "dey completely damaging from di beginning sake of say I be president of Opec."
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/cgl3epj8gyyo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Morocco captain Achraf Hakimi go stand trial for alleged rape, French prosecutors don confam.
One woman bin accuse di Paris St-Germain defender of raping her for im house for di French capital for 2023, wen she be 24 years.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cy4ek20dwpxo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Scotland go face Morocco for one important Round 2 Group C match for Fifa World Cup on Friday for Boston Stadium, as both teams dey come into di game afta good results for dia first matches.
Wetin be your prediction?
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c1wy34zz50yo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Premier League champions Arsenal go open di 2026/27 Premier League season wit home game against new boys Coventry City on August 21.
Man U go travel away to Hull City, Manchester City go host Bournemouth while Liverpool go travel to Newcastle.
www.bbc.com/pidgin/articles/c04ye3kdlr1o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Premier League fixtures for di 2026-27 season go dey released on Friday at 9 AM GMT (10 AM WAT).
Di fixture announcement dey come one hour later dan di time dem dey release am for di past years.
Wetin be your expectation?
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c04ye3kdlr1o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Ekiti State pipo go cast dia votes on Saturday, 20 June for one of Nigeria most closely watched off-cycle govnorship elections.
Voting go take place across all di 16 local govment areas, 177 wards and 2,445 polling units.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cx2xqyl0qnlo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di two kontris no go like di scoreline but South Africa fit happy small.
Dis na becos both Czech and South Africa go now dey under pressure to win dia last Group games.
Dem bin lose dia first games and wit today score, e mean say dem only get one point.
www.bbc.com/pidgin/articles/c70y684x8xno -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Mokoena don equalize for South Africa - afta dem get penalty from Czech foul inside 18.
Live updates: www.bbc.com/pidgin/articles/c70y684x8xno -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
You dey look South Africa and dey wonder wia di reaction from dia last game?
Wetin you go like see for dis 2nd Half?
Live updates: www.bbc.com/pidgin/articles/c70y684x8xno -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
US dollar na di currency wey pipo dey trade pass for di world, but e no be di strongest currency for di world - di storngest currency for di world now na Kuwaiti dinar.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/cwyl51pn5rko -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
South Africa don begin collect again.
Sadílek score di opening goal afta beta pass from just outside box 18.
Live updates: www.bbc.com/pidgin/articles/c70y684x8xno -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Mexico sama South Africa 2-0 for di opening game but di talking point na about di three red cards for di game.
But wetin go happun today wit Czech Rebublic?
Follow live updates hia: www.bbc.com/pidgin/articles/c70y684x8xno -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Nollywood actors and celebrities full Abia state to pay dia last respect to dia colleague Alexx Ekubo wey die afta im battle wit kidney wahala.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c20yxjrj19wo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Na on Friday US and Iran dem go formally sign am for Switzerland – wey go make way for dem to reach a "final deal" within "a maximum of 60 days, wey dem still fit extend wit mutual consent."
www.bbc.com/pidgin/articles/cg4wvq479wro -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Czech Republic go face Bafana Bafana of South Africa for Group A game for di ongoing Fifa World Cup.
Di match go take place for Atlanta Stadium, United States wia thousands of fans and supporters go watch di two teams.
Wetin be your prediction?
www.bbc.com/pidgin/articles/c70y684x8xno -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Argument don burst for social media afta political singer Dauda Kahutu Rarara criticise popular Afrobeats star Davido ova di outfit wey e wear go Fifa World Cup Countdown Concert for Los Angeles.
Davido don fire back at di Kano-based singer.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cx2vxnpvnq3o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Nigeria former minister of petroleum resources Allison-Madueke don tank God and pipo wey stand by am during her trial for di United Kingdom.
Court for UK on Wednesday, 17 June bin clear Alison-Madueke of six bribery charges.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cgmd8e3re9ko -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Nigerian actor, filmmaker and entertainer Alexx Ekubo wey die at di age of 40 dey take im final journey home today.
Dem go bury di late actor for Abia State wia family, friends and fans go gada to wish am final goodbye.
www.bbc.com/pidgin/articles/c20yxjrj19wo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Residents for Niger capital say dem hear explosions and gunfire wey dey come from di airport.
Dem say di blast start around 06:00 local time (05:00 GMT) on Thursday, 18 June.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/ckg74nlj3p5o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di pipo of Ekiti State go cast dia votes on Saturday, 20 June.
11 candidates including Govnor Biodun Oyebanji dey vie for di number one political seat of di state.
Dis na di candidates profiles and dia promises to di pipo of di state: www.bbc.com/pidgin/articles/c05yn1nqd4zo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Ghana Black Stars begin dia 2026 World Cup campaign wit 1-0 win ova Panama.
Young midfielder Caleb Yirenkyi score di only goal for di 95th minute afta one fine counterattack.
How you go take rate Ghana performance?
Match highlights: bbc.com/pidgin/articles/c74yz1lxgl9o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Portugal and DR Congo create beta chances to score more goals but dem no fit convert dem.
Portugal top player Cristiano Ronaldo play full time but DR Congo defenders no let am see road well to score.
Portugal vs DR Congo highlights: www.bbc.com/pidgin/articles/cz759pn0jexo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Dis clarification dey come afta IMF suggest say make Nigeria add VAT for fuel products and start excise duty for telecommunication to raise money for di development of infrastructure rather dan make dem just dey settle loans.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cr47np21xnko -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Ghana and Panama go play dia first Group L match of di 2026 World Cup today.
Di game go happun for di BMO Field for Toronto, Canada.
Fans tell BBC News Pidgin wetin dem dey expect from di game wey Africans go watch for midnight.
#ghana #panama #worldcup #thomasparteyThis media couldn't be displayed. See it on the original post. -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Magical moment for DR Congo wey shock Portugal wit equalizer.
Yoane Wissa score DR Congo first-ever goal for World Cup.
Live updates: www.bbc.com/pidgin/articles/cz759pn0jexo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Portugal 1-0 DR Congo
Portugal dey press but DR Congo no dey gree
Players dey take water water break.
Live updates: www.bbc.com/pidgin/articles/cz759pn0jexo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di trial happun for Southwark Crown Court for London and e take di court just more dan 46 hours to decide on di mata.
Alison-Madueke na minister for petroleum resources between 2010 and 2015 under former president Goodluck Jonathan.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/cgmd8e3re9ko -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Portugal 0-0 DR Congo
Cristiano Ronaldo, Fernandez, Wissa all start for di 2026 World Cup Group K match
Follow live updates: www.bbc.com/pidgin/articles/cz759pn0jexo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di 2026 Fifa World Cup wey start 11 June wit di opening match between Mexico and South Africa don kontinu to bring surprises wey dey entertain football fans.
Wetin be di World Cup standings:
www.bbc.com/pidgin/articles/c9q2lx5ye1ro -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Neighbours say di smell from di property don become so bad sotay e don come dey impossible to relax for house.
Saidu, wey im job na to dey empty sceptic tanks, say im dey sell di poo-poo to farmer.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c621x0ynn89o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
According to letters by Canada immigration ministry wey dem share wit di BBC, dem tok say di recipients "fit no dey entitled" to dia certificates of citizenship and ask make dem return am.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/c04y5gg7157o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
For Nigeria, cases of snake bite dey common even though plenti of dem no make am to di news, especially for remote areas, but young Taiwo Okikiola dey raise awareness about dis reptile and dia medical benefits.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c07y8z72z91o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Ghana and Panama go face each oda for di first time for Thursday midnight as anoda African kontri dey try to get good result for dia first game for di 2026 World Cup.
Who you tink say go replace Thomas Partey and wetin go be di outcome of di match?
www.bbc.com/pidgin/articles/c74yz1lxgl9o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
South Africa don bicom hostile place for undocumented migrants, as deadline wey protesters set for dem to comot for di kontri dey near.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c5yzpl30ev7o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
European football giants Portugal go start dia Fifa World Cup 2026 campaign wit one big match against DR Congo for Texas, and many pipo dey expect exciting football.
Wetin be your prediction?
www.bbc.com/pidgin/articles/cz759pn0jexo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di pipo of Bille Kingdom for Degema Local Govment Area of Rivers State, south-south Nigeria dey cry to di Nigerian govment to stop di gas leak wey dey pollute di town.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cp36ynn4y4zo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Lionel Messi na whoever im tok say im be. Di Argentine and Inter Miami forward score hat-trick to reach 16 World Cup goals.
E mean say di 38-year-old dey share World Cup highest goal scorer wit Miroslav Klose of Germany.
Use one word take describe Messi performance. -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di 2022 World Cup finalist been no too play well for di first half wey end 0-0 sake of Senegal strong defend and dia goalkeeper Edouard Mendy.
France vs Senegal highlights: www.bbc.com/pidgin/articles/cn5925e5nw4o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Canada Federal Court don dismiss motion wey Ghana midfielder Thomas Partey file to challenge im visa refusal to play di Ghana World Cup game against Panama
Afta more dan one hour of hearing di arguments Judge Roger Lafreniere return to dismiss di appeal www.bbc.com/pidgin/articles/c74yz83mjjyo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
France 3-1 Senegal
Mbappe again!!!
Live updates: www.bbc.com/pidgin/articles/cn5925e5nw4o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
France 1-0 Senegal
Les Blues 🇫🇷 don begin press Senegal for neck.
Kylian Mbappe don become France all time highest goal scorer.
Live updates: www.bbc.com/pidgin/articles/cn5925e5nw4o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Presidential candidate of di National Democratic Congress (NDC) Peter Obi say im no go spend pass four years for office.
E tok dis one ontop one podcast show wey dey trend for social media.
Oga Obi say im achieve many tins wey im don promise in four years. -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
France 0-0 Senegal
Senegal don really play pass France for dis first half. Na goal dem neva score.
But wetin dey do France? Abi na becos too many stars dey play at di same time?
Live updates: www.bbc.com/pidgin/articles/cn5925e5nw4o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
France 0-0 Senegal
Senegal go fit repeat wetin dem do for 2002? We go know in 90mins.
Follow live updates hia: www.bbc.com/pidgin/articles/cn5925e5nw4o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Appeal court no happy say Justice Peter Lifu of di High Court for Abuja to go ahead wit di judgment despite Appeal court order on ADC mata.
Di Court of Appeal say na serious violation of di hierarchy of di court and di 1999 Constitution.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/cq81y8yvqjjo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Afta more dan one hour of hearing di arguments form di Canada ministry of citizenship and immigration and lawyers for di 33-year-old player, judge Roger Lafreniere take break to prepare im ruling.
Follow live updates: www.bbc.com/pidgin/articles/c74yz83mjjyo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Ghanian authorities argue say Ofori-Atta na still citizen of Ghana and dem still fit return am back to Ghana if di extradition court for di United States agree.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c0ry580xn7go -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di pipo wey go court rely on di section and provisions of di Electoral Act and insist say di parties fail to win elective seats for di general and bye election or meet minimum requirements for elections.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/cq81y8yvqjjo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
South Africa Home Affairs say dem don block di identity documents of some nationals, and say make dem go present demsefs to officials.
Full tori: bbc.com/pidgin/articles/c4gyen98jx9o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di General daughter, Bilikisu Rabe Abubakar confam her mama release to di BBC.
Inside one statement on Monday, di military say Amina Abubakar bin regain freedom afta "intensified search-and-rescue efforts".
www.bbc.com/pidgin/articles/cy5vn7y6wnwo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Pundits and fans predict say Spain go win dis game but afta 90 minutes na Cape Verde dey smile as dem get dia first point for di World Cup.
Highlights: www.bbc.com/pidgin/articles/cjwg2qwe1ggo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
According to am di founding father of ADC na from South-East and if dem no select anyone from di region e mean say dem still dey face marginalisation as di region neva produce any president or vice president candidate since 1999.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/cq51zjd920do -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di govment tok say dem no plan to put messaging services like WhatsApp and Signal for di social media ban.
But which apps di social media ban for UK go affect?
Full tori dey hia: www.bbc.com/pidgin/articles/c982467d2g6o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Minister of Justice, Oga Fagbemi tell tori pipo for court say dis exercise na to show say di present govment for Nigeria dey determined to fight terrorism and insecurity to standstill.
Full: www.bbc.com/pidgin/articles/cz6v19p931yo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Spain 0-0 Cape Verde
World Cup debutants Cape Verde dey play dia first ever World Cup game.
Follow live updates: www.bbc.com/pidgin/articles/cjwg2qwe1ggo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
For statement wey ADC release di party tok say di kain experience wey Amaechi get na only few pipo get am for di kontri.
But wetin go happun now wey Court don tell Inec to to comot ADC and oda parties from dia register.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/cq51zjd920do -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Na Nigeria Minister of Justice, Lateef Fagbemi, and Ethiopia Justice Minister, Hanna Arayaselassie, sign di documents for di transfer of pesin wey dem don sentence.
www.bbc.com/pidgin/articles/c3ey142wpq8o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Spain vs Cape Verde na one of di matches wey pipo go chook eye for today for di 2026 World Cup.
Dis na becos dis Cape Verde dey play dia first World Cup match in dia history against former World Cup winner.
See oda matches wey dey today: www.bbc.com/pidgin/articles/c9q2lx5ye1ro -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
United States and Iran don marshal out framework deal wey go help end di war wey dey go on between dem.
Dia mediator wey be Pakistan say dem go sign di deal on Friday for Switzerland.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cewqkd8jxqyo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Alt-pop US musician and internet personality Oliver Tree dey among di six pipo wey die wen di helicopter e bin dey travel inside jam anoda one for Brazil.
Di 32-year-old bin dey on world tour wen di accident happun for Rio de Janeiro on Sunday.
www.bbc.com/pidgin/articles/cy4elk1w5k3o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di family of retired Major General Rabe Abubakar don call on di govment to intensify efforts for di rescue of im wife wey still dey for kidnappers den.
Abubakar daughter say di death of di retired military officer don put di family for unbearable pain.
www.bbc.com/pidgin/articles/cvgj1py632no -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Nigerian authorities say retired Major General Rabe Abubakar don die.
Dem say di retired senior military officer die for di hand of bandits wey abduct am.
Meanwhile, Katsina govment say na natural complications kpai di retired military officer.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/c4gy37evpx3o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
If you be pesin wey dey swallow food wey no dey chew am and you dey rush food too, come forward.
One study don show say to chew your food well for mouth bifor swallow get benefits wey include brain improvement.
How you dey chop your own food?
Read here: www.bbc.com/pidgin/articles/c4gyxp1ynylo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Elon Musk don become di world first trillionaire afta SpaceX shares go public for one US stock exchange.
But dat one no mean say e get di money for bank.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c8r2jnr8vm0o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Ghana govment say dem bring back more dan 220 of dia citizens from Ivory Coast on 11 June 2026.
Authorities dey prepare to bring back about 100 odas on Friday, 13 June.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cx23w1kdnk9o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Pipo from African kontris bin give dia support to Mexico against South Africa during di World Cup opening match wey happun yesterday and also yab dia African brothers afta dem chop 2-0.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cp8lndjpx3no -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
For im nationwide broadcast to celebrate 27th Democracy Day on Friday, Tinubu announce national awards to 51 Nigerians.
Some of di awardees lawyers, journalists, and retired military officers and pro-democracy activist, wey fight for Nigeria democracy.
www.bbc.com/pidgin/articles/cn94g8z94rpo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di young men, all from Iraqi Kurdistan, bin dey captured for Libya by a militia wey demand a ransom of $5,000 (£3,700) from each of dia families, and threaten to harvest di captives kidneys if dem no make payment sharp-sharp.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/c892lnj12xpo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
For di first match of di World Cup Mexico beat South Africa 2-0 for game wey see three red cards.
South Korea come from back to knack Czech Republic 2-1 for di second game.
Check out di standings and fixtures: www.bbc.com/pidgin/articles/c9q2lx5ye1ro -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Nigeria bin dey celebrate dia democracy day on May 29, di date wen di military hand over power to a democratically elected president for 1999.
Di last of such handover bin happen on October 21st, 1979.
www.bbc.com/pidgin/articles/c932gyg2vp3o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
One phrase to describe di match na Day of di Reds as South Africa wey Mexico sama wetin no good chop 2 red cards, while di North American kontri collect one.
Di match end for 2-0 in favour of El Tricolor.
See how di match take waka: www.bbc.com/pidgin/articles/cpq39zz7255o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Mexico dey show South Africa shege as dem score anoda goal while di Bafana Bafana neva see any goal.
Wetin be your prediction?
Live updates: www.bbc.com/pidgin/articles/cpq39zz7255o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
First half end for 1-0 as Mexico dey lead South Africa.
Di Bafana Bafana of South Africa go fit equalise?
Wetin be your prediction?
Live updates: www.bbc.com/pidgin/articles/cpq39zz7255o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Nigeria House of Representatives, di lower house of parliament don pass di bill for di establishment of state police.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/clyexnrll4jo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Nigerian govment bring back 268 citizens from South Africa sake of xenophobic attacks as more pipo dey expected for di kontri next week.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cj9gn98mxnxo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Time go soon reach as South Africa dey face Mexico for di 2026 Fifa World Cup.
Who you dey root for and wetin be your prediction?
www.bbc.com/pidgin/articles/cpq39zz7255o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Nigeria don bicom di latest African kontri to comot some of dia citizens from South Africa sake of xenophobic attacks.
One flight wey carry 268 Nigerians don land Lagos afta e comot Johannesburg on Thursday morning.
www.bbc.com/pidgin/articles/c5yz5p7zg42o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
US President Donald Trump say di kontri go hit Iran "veri hard" tonight.
Trump also vow to "assume total control" of Iran oil and gas markets and to take Kharg Island, wey be major oil terminal off di coast of Iran - for "future wey no too far".
www.bbc.com/pidgin/articles/cdxdzy2kg57o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Afta many months of tok-tok and buildup, di World Cup finally dey hia and afta di colourful opening ceremony wey go happun for di Estadio Azteca for Mexico City dis evening, di football go begin.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/cpq39zz7255o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Dis bill want make dem change di name of di Nigeria Police Force to di Nigeria Police Service, and allow di creation of State Police, State Police Councils and State Police Service Commissions.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/clyexnrll4jo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Though di Super Eagles miss out on di tournament wey go happun for US, Mexico and Canada – players wey get Nigerian roots full for di World Cup.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/cx2jd4xe2vlo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Dis Nigeria citizens dey return sake of di protests and attacks on illegal migrants wey don dey happun for weeks across South Africa.
Oda kontris like Ghana, Zimbabwe, Malawi and Mozambique don carry some of dia citizens comot from South Africa.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/cj9gn98mxnxo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di 2026 Fifa World Cup go start today 11 June and end on Sunday 19 July.
Di first match dey happun today between di host Mexico and South Africa.
Enta di link to see all di fixtures: www.bbc.com/pidgin/articles/c9q2lx5ye1ro -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
United States govment say dem don end illegal birth tourism schemes, as dem scata one multiple international birth tourism networks for West Africa, North Africa and Europe and withdraw hundreds of visas.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cx2d8gd7y4no -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Gunmen on Wednesday 10, June, attack Iluke Community for Bunu District of Kabba-Bunu Local Govment Area of Kogi State.
Dem kpai three pipo including one three-year-old pikin and one vice principal.
Full tori: bbc.com/pidgin/articles/c7vy307v577o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Blessing CEO don get anoda court case around her neck as EFCC don arraign multiple times ontop different charges.
All her court cases dey here: www.bbc.com/pidgin/articles/cvglx32n00mo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
EFCC don arraign Blessing Okoro aka Blessing CEO ova alleged 13 million naira fraud.
According to di influencer, Nigerians bin donate 13 million naira for her afta she come out to solicit funds for stage 4 cancer treatment.
www.bbc.com/pidgin/articles/ckg5z4r691zo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
For im defence, oga Mark Okoye tok say evri expenditure wey di SEDC don do so far under im management dey lawful.
Dem create di SEDC to help bring more development to di five States wey dey for di southeast region of Abia, Anambra, Ebonyi, Enugu, and Imo.
www.bbc.com/pidgin/articles/c5yzx3qp2d7o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di 2026 Fifa World Cup go start on Thursday 11 June and Sunday 19 July.
48 team, 104 games and over one month of ogbonge football for three kontris - USA, Canada and Mexico.
Dis tori get all di fixtures, tables and all : www.bbc.com/pidgin/articles/c9q2lx5ye1ro -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Dem declare eight men and three women dead for di scene, while anoda man later die for hospital.
www.bbc.com/pidgin/articles/cdjk3xxxkg9o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
EFCC arraign Blessing CEO on two-count charge wey border on obtaining money by false pretence & stealing to di tune of N69,150,000.
Dis dey come di same day one Federal High Court for Lagos grant am bail ontop accuse of rental fraud wey reach 36m naira.
www.bbc.com/pidgin/articles/cvglx32n00mo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di US don send former CEO of di Ghana Microfinance and Small Loans Centre (Masloc) to Ghana afta she run away from her 10-year-jail term.
Di High Court for Ghana bin sentence Sedina Tamakloe Attionu to 10 years in prison in absentia afta her trial.
www.bbc.com/pidgin/articles/cp3xwgk382no -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
"Despite di circumstances, I dey positive mood and I dey focused on di next challenges for my refereeing career."
Omar Artan begin trend yesterday afta immigration authorities no allow am enta di US wen im land di kontri on Monday.
Who be Omar Artan: www.bbc.com/pidgin/articles/cly9v5gld9xo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Judge rule say make EFCC keep Blessing CEO for correctional facility pending wen she go perfect di bail conditions.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/ce8kdx2y6d3o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Bianca Odumegwu-Ojukwu insist say di accuse wey South African citizens dey make say most of di Nigerians for di kontri na illegal immigrants, na lie.
www.bbc.com/pidgin/articles/cm2r8g24eg1o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Fifa say dem ban di listed items to reduce di risk of injury wey fans wey dey throw missiles dey cause.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/c78y59l7448o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Good morning!
Today proverb na from Chijindu Ike.
Reason am well and share your own for comment. -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Ghana don bring back almost 1,000 citizens from South Africa sake of xenophobic attacks.
Malawi govment don also comot 150 pipo from South Africa as Nigeria postpone repatriation of dia citizens.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c5yz5p7zg42o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Wen Luiza Silvério first sight her wife for di convent wia dem go at 19 years old novices, dem bin hate demsefs
Later on, dem become friends, fall in love and marry demsefs.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cp8pgp4j20mo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
President John Mahama for im state of di nation address on 27 Febraury 2026 announce say no health facility gatz turn away patients wey dey need emergency care, afta one engineer die when three public hospitals turn am away afta one motor accident.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/c8720pgnpgqo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Dis war don weaken di Iranian regime - na how Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu take describe Iran threat to Israel wey don dey exist since - but e neva lead to dia collapse.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/c9w2kpkrj45o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
So far, more dan 1,000 Nigerians don dey screened and cleared to return home from South Africa, according to Nidcom.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cevlyxl30rro -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
"E bin dey veri hard for me to trace how I take get HIV becos of say wen I bin dey veri young, I bin dey carry women.”
Nigerian content creator Chika Wonder advise pipo on di need to stick to one partner as e share im journey wit BBC News Pidgin.
#hiv #advocacy #education_systemThis media couldn't be displayed. See it on the original post. -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Officials no go give us exact numbers about dos wey dey di camp, except to say di Africans wey dey dia come from 15 different kontris.
Follow di full tori hia: www.bbc.com/pidgin/extra/k2kcjn0j0i/africa_prisoners_ukra… -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Chika Wonder dey use im social media platforms educate and matchmake pipo wey dey live wit HIV.
E share im journey wit BBC News Pidgin, di stigma e don face and wetin dey drive im educative contents about HIV.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cq61r1rnzmro -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
You don see videos and fotos wey dey spread for social media say bandits enta Lagos?
But say na true say bandits don enta places like Lekki and Ikorodu as pipo dey spread for social media?
Police give us di true picture of wetin happun.
Read full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cy425349395o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Quick fire questions wit Nigeria entertainer and streamer, Carter Efe.
During interview wit BBC News Pidgin, @carterefe__ pick between Davido or Wizkid.
Carter Efe also pick between Trump and Tinubu, Ronaldo and Messi, amongst odas.
Producer/Edit: @oloyenaija1This media couldn't be displayed. See it on the original post. -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di lorry don leave from di Malian town of Telhandek but e change from im intended way, di govnor tok.
Dem burry di victims for mass graves by di rescue team wey di local authorities send come di area.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/cx212gzgg78o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Na about two weeks now wey all political parties for Nigeria conclude di primaries for aspirants wey wan contest for different positions for di 2027 general elections.
www.bbc.com/pidgin/articles/cgepe8xlen8o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Fans for more dan one quarter kontris wey dey take part for di World Cup dey face travel ban or oda issues to get visas, analysis of travel data by di BBC World Service don show.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/c2l2lv7gvk7o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Nigeria Police Force don warn against di spread of fake news and false security alerts wey don dey on di rise for states across di federation, following di abduction of pupils and teachers from schools for Oyo and Borno states.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/clypy397zz4o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Nigerian electricity consumers fit start to dey sell excess electricity to di national grid.
But no be evribodi fit benefit from dis initiative - but who fit partake in dis? Dis na wetin di tori explain: www.bbc.com/pidgin/articles/cqlpqq59pp1o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Bayo Onanuga wey be di Special Adviser to di President on Information and Strategy on Thursday, 4 June say di Inspector General of Police crack team gbab di suspect for Benin.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/ckgpged5k4lo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di 2026 Fifa World Cup go kick off on Thursday, 11 June.
Dis tori take you around di beautiful and iconic stadiums wia dem go play di World Cup: www.bbc.com/pidgin/extra/r4ley0rbhs/world-cup-2026-stadiu… -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
For one video wey capture di Oyo State House of Assembly sitting on Wednesday di Speaker dem no go negotiate wit di kidnappers sake of say dia demand get as e be.
www.bbc.com/pidgin/articles/cm2p2yvv1mko -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Some of di popular artists for di Fifa album na Major Lazer, Nelly Furtado and Davido on 'No Place Like Home,' Shakira and Burna Boy on 'Dai Dai,' IShowSpeed on 'Champion', Lisa, Anitta and Rema on 'Goals'.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/c98r845208eo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Under di new plan authorities outline fresh sponsorship guidelines wey go punish higher institutions wey no employ students properly
"Di new sponsorship rules go introduce sliding scale of penalties for higher institutions wey fail to recruit responsibly"
www.bbc.com/pidgin/articles/cwy2y4rvy2vo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
FBI don shoot and kpai one man wey bin dey hold plenti pipo hostage overnight inside one California bank.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cq5pv4qye13o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
One pesin die afta two-story building collapse for Adenta new site for Accra during heavy rain on Wednesday night.
Di same night, fire burn Makola Market and police barracks.
Full tori: bbc.com/pidgin/articles/cpwp49ezk1vo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Despite di big money wey govment dey spend on defence, insecurity na still one of di major problems Nigeria dey face.
Many children and dia teachers wey gunmen kidnap for Oyo and Borno still dey for captivity more dan two weeks afta di incident happun.
www.bbc.com/pidgin/articles/ckgpr3n95j0o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Inside court paper di Shell argue say most of di pollution no be dia fault na high level oil theft, sabotage and many illegal refineries dey cause am
BBC ask di Nigerian govment to respond to Shell claim say di authorities no fit handle di organised crime www.bbc.com/pidgin/articles/ce9pkrzgpm5o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Nobody don win di World Cup Golden Boot more dan one time - but two men get beta chance to becom di first to do am dis summer.
Striker wey go dey successful need two tins - good supply line and for dia team to go far for di tournament.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/c62xpn30w7no -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
These kidnapping incidents don bicom one of di most poppular school kidnapping in recent years, since di Chibok and Dapchi cases, and e bring back painful memories to di minds of Nigerians.
Full tori dey hia: www.bbc.com/pidgin/articles/cwy240xx7nlo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Justice Emeka Nwite say di prosecution prove dia case well-well especially as one of di victims at di attack identify two of di suspects say dem follow enta di Church on dat day.
Read: ttps://www.bbc.com/pidgin/articles/cj9pm3ln4e8o?at_campaign=ws_whatsapp -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Unknown gunmen don kidnap one woman and her two children wey dey related to Nigeria former minister of Power, Bayo Adelabu, for Challenge area of Ibadan, southwest Nigeria.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cx21wkg9l2eo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Evangelist Mike Bamiloye, don lend im voice to defend di General Overseer of di Redeemed Christian Church of God, Pastor Enoch Adeboye, afta mixed reactions follow di cleric comment on di security challenges wey di kontri dey face.
ttps://www.bbc.com/pidgin/articles/cn8pwqv237xo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Police for California don confam say ongoing hostage situation dey happun for Bakersfield area of di state and dem don shutdown di area.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cq5pv4qye13o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Gunmen on 5, June 2022, bin attack one Catholic church for Owo, Ondo State, and kpai dozens of pipo including children.
Court go sentence di suspects today.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cj9pm3ln4e8o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di pipo of Badawa, one village wey dey for Bodinga Local Govment Area of Sokoto State, northwest Nigeria, dey call on authorities to urgently repair dia primary healthcare centre, wey dem say don remain for bad condition for many years.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cwy24eql1nwo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
According to one internal memo dem neva set date wey dem go implement dis changes, but e go happun dis month of June.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/c5yennjz5eyo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Pastor Adeboye tok say say "If dem ask me to make suggestions, I go tell our govment quietly say make dem move fast and tell our security chiefs to get rid of dis terrorists dem within 90 days or resign".
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/cn8pwqv237xo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Minority Leader for di House of Representatives, Kingsley Chinda don defect to APC.
Di date wey dey ontop di defection letter carry 23, April, 2026, weeks before e emerge as APC guber candidate for Rivers state. .
Tori of Chinda sack by Rivers APC: www.bbc.com/pidgin/articles/c8e8zjlj9npo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
As di 2026 Fifa World Cup dey ready to kick off, plenti nations don release list of dia players wey go follow play for di World Cup, including di ones from Africa.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cn7pn2j50yjo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Redeemed Christian Church of God (RCCG) wey be one of di largest Pentecostal Church for Africa don clear di air on wetin dem call "false narratives" wey dey spread about di Church and di General Overseer Pastor Enoch Adeboye.
www.bbc.com/pidgin/articles/cn8pwqv237xo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
E don reach more dan two weeks wey gunmen kidnap pupils and teachers for Oyo and Borno states.
Teachers for Nigeria don begin protest and dey call on govment to rescue di victims.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c62xy19x97do -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di reinstated leadership of di All Progressives Congress for Rivers State don declare as invalid all nominations and decisions wey arise from di party recently concluded primaries for di state.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c8e8zjlj9npo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di US still get powerful naval and air force within striking distance of Iran.
E dey safe to assume say di Iranian regime for don keep dia forces on high alert and dem go dey use di ceasefire to re-organise and repair di damage wey US and Israel don do.
www.bbc.com/pidgin/articles/cewpe01dg2qo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
You don see wia fire dey burn on top water?
For ova two years, na so fire dey burn on top di river for Ofiomina-ama Alakiri Oil well 9 for Ofiomina-ama Alakiri community for Koniju town, Okrika local govment area of Rivers State for Southern Nigeria.
www.bbc.com/pidgin/articles/c759p6222dzo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di deadline by di Independent National Electoral Commission (Inec) for political parties for Nigeria to conclude dia primary elections and submit di names of candidates wey go contest for di 2027 general elections, don pass.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/cwy27p1exzno -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Afta Ghana parliament pass di 'Human Sexual Rights and Family Values bill' wey be popular as anti-LGBTQ bill for di second time on Friday 29 May 2026, pipo dey react to am.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cj6pj53zzelo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Oyo State chapter if di Nigeria Union of Teachers (NUT) don start indefinite strike dis Monday morning sake of di primary school pupils and teachers wey jaguda pipo bin kidnap from three schools for Ogbomoso, Oyo State.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cp3pg1lpnddo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Nigerian Civil War claim di lives of estimated 500,000 to three million pipo.
Grammy-winning Nigerian director, wey im grandpapa na Godwin Alabi-Isama, document im grandpapa and oda pipo experiences for di war wey kpai mostly children.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cq6p3n3l73ro -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Today na today ooo!
Arsenal dey hope to win dia first Champions League while PSG dey look to retain di title.
Rememba say PSG flog Inter Milan 5-0 for last year final.
Wetin go happun for dis final and who you dey support?
#arsenal #psg
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c62rjz8874no -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Peter Obi na di only aspirant wey pick nomination form for NDC and e fit become di main flag bearer.
Inec set 30 May as deadline for parties to submit di names of dia candidates wey go contest di 2027 general election.
Wetin you dey expect?
Read full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cm2pq400zq4o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di office of Nigeria former President Goodluck Jonathan don disown di social media account wey dey impersonate am.
Oga Jonathan media aide, Ikechukwu Eze, say one Instagram account dey impersonate di former president.
E add say Oga Jonathan no get Instagram account. -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Evri year for Ijebu-Ode, Ogun State, di streets dey transform into a moving gallery of colours, prestige and history.
Ojude Oba no be just festival - na statement of identity.
Full tori: bbc.com/pidgin/articles/c152103e5y8o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Nigeria President Bola Tinubu don spend three years ontop di seat of power and Nigerians don chook mouth into how di president don perform since e assume office.
How you go rate President Tinubu three years for office?
Full tori: bbc.com/pidgin/articles/cj60lw1z7d6o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Afta interviews wit di students and staff and one forensic review of CCTV footage, police identify eight pupils for di school as "persons of interest in connection wit di planning and execution" of di fire, di National Police Service tok for statement.
www.bbc.com/pidgin/articles/cn0p7ngl6zyo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
As di primary elections wrap up for di different political parties, tins don dey clear about which candidates go contest di 2027 general election..
For di ruling APC, President Tinubu emerge di candidate with almost 11 million votes.
www.bbc.com/pidgin/articles/c3e2kz8x2kno -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
For statement on social media, Blue Origin say "dem bin don experience say sometin no dey okay" during di hotfire test. Dem add say all dia personnel dey accounted for.
Full tori dey hia: www.bbc.com/pidgin/articles/cvgz0n93jzro -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
For one nationwide broadcast to mark di third anniversary since e bicom di President, Oga Tinubu admit say im administration neva solve all di kontri problem finish, and things neva dey as e suppose be, but dem don lay di foundation for progress.
www.bbc.com/pidgin/articles/clypem1ze5lo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Afta Arsenal win dia first league in 22 years, di club go wan top am wit Champions League win dis weekend.
But e get advantage wey PSG get pass Arsenal as dem go face off for di Champions League final.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/czr2x5y2kvyo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Edo State govment don react to di incident wey happun on Children Day wia dem security use tear gas.
Di incident happun for Samuel Ogbemudia Stadium for Edo wen children bin gada to celebrate di 2026 Children Day.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c142y4e7dvno -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Dis na di second time in three days wey di US don attack targets for Iran - dem say di strikes na in self defence.
Centcom say dem strike di site for Bandar as e dey about to launch a fifth drone, Iranian media report say dem hear explosions.
www.bbc.com/pidgin/articles/c62e1kk8zd2o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Nearly 300 Ghanaians, including women and children, comot from South Africa land safetly for di home kontri afta dem bin express dia iterest to return home.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/ce3p740dyg8o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
For dia official X handle, ADC give breakdown of di primary election results" for di final results from di presidential primary of di ADC Hayatudeen- 177,120, Amaechi- 504,117, Atiku 1,846,370.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cq6pplyr14vo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di fire start for di Utumishi Girls Senior School for di early hours of Thursday morning wen di students bin still dey sleep, according to di Kenya Red Cross and police.
www.bbc.com/pidgin/articles/cn0p7ngl6zyo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Diana be one of many Ghanaians and foreign nationals wey face daily harassment and physical attacks for South Africa as dem blame foreigners for taking dia jobs and di kontris high rate of crime.
www.bbc.com/pidgin/articles/clyp7pd4dqwo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di death of Wendy Achumba wey be 21-year-old nursing student don lead to di arrest of two suspects.
Dem allegedly rape and kpai am.
Dis na di cases of women like Wendy wey die for similar circumstances: www.bbc.com/pidgin/articles/cjrppgjy247o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Nearly 300 Ghanaians, including women and children, wey di govment help to comot from South Africa don arrive for Accra.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/ce3p740dyg8o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
"VDM need to face di weight of di law say e dey share fake audio of President Tinubu", dis na wetin Nigerian Presidency write about Very Dark Man afta di circulation of one AI-generated audio wey pesin place on VDM video.
www.bbc.com/pidgin/articles/cn4prg9jmgmo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
BBC see dozens of buses wey Ghanaian embassy charter dey drop passengers for Johannesburg OR Tambo airport around 03:00 local time (01:00 GMT) on Wednesday.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/ce3p740dyg8o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
ADC start collation of results from dia Presidential Primary Election wey go decide dia candidate for di 2027 General Elections dis week.
Di party for statement tok wen dem resume collation of results sake of di Eid Mubarak celebration.
www.bbc.com/pidgin/articles/cd6pp8gl1p8o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Muslims around di world dey celebrate Eid two times evri year, and Eid al-Adha na di second of di two feasts.
E dey happun just over two months afta Eid al-Fitr, and na im holy pass for di two festivals.
www.bbc.com/pidgin/articles/c5yrz49q562o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Happy Eid Mubarak to all our Muslim followers.
#bbcnewspidgin #sallah #eiduladha #mubarak #muslims -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Only seven players wey be 40-year-old and above don feature for di men's World Cup since di tournament start 96 years ago - and at least five more fit join di list afta dia kontri don name dem among di squad for dis year contest.
Who dem be? www.bbc.com/pidgin/articles/c62669d5qd8o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Results of African Democratic Congress wey don dey announced so far show say Atiku Abubakar dey lead.
Former Rivers State govnor Romiti Amaechi don reject di results ahead of official announcement by di party.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cq6pplyr14vo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Ousmane Sonko, di former Prime Minister of Senegal wey President Diomaye Faye bin sack, don emerge di new Speaker of di kontri National Assembly.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cn4ppygk4yeo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Wen di US-Israel war with Iran bin first start for di end of February, no be just di Middle East dey feel am.
Dis na how di Iran war dey shake global currencies: www.bbc.com/pidgin/articles/cx211y9ke25o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Inec list nine grounds of appeal, and more dan 60 "particular errors" wey dem claim say Justice Umar bin commit for law wen e deliver dat judgement.
www.bbc.com/pidgin/articles/cvgzz37gp8go -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
US Secretary of State Marco Rubio defend di strikes.
US carry out di strikes despite say dem dey hold tok-tok wit Iran ontop peace deal wey go finally end di war.
www.bbc.com/pidgin/articles/c7599k493pno -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Justice Lifu tok say di pesin wey carry di mata go court to try stop former President Jonathan na busy body – becos di mata no concern am.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/c7599kgq6keo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di 48 national teams wey dey involved must register squad of between 23 and 26 players, including three goalkeepers, on or bifor Tuesday, 2 June.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/cj6px3jx21ro -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Na yesterday ADC start di process to choose di presidential candidate wey go face President Bola Tinubu for di 2027 presidential election.
Party members across di 36 states of di federation plus di FCT go follow for di presidential process.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cq6pplyr14vo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Key players miss out sake of injury and many Ghana players wey dem select suffer relegation for dia clubs.
But who and who dey Black Stars squad.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/c0m22gz3g9yo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Suspected armed bandits kidnap ten pipo for Yashikira community, Baruten Local Govment Area of Kwara State for di early hours of Monday, 25 May go unknown destination.
Dis na timeline of attacks since gunmen kpai Oyo teacher: www.bbc.com/pidgin/articles/cvgzzml7xv7o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di family of late actor Alexx Ekubo don release im burial arrangements.
Alexx die of metastatic kidney cancer on Monday, 11 May at di age of 40, and many of im colleagues and fans bin pay tribute to di talented actor.
Full tori: bbc.com/pidgin/articles/ce8ppvj623do -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di South Africa govment don confam say dia security ministers dey meet to discuss di rising anti-immigration protests across di kontri wey begin for early April.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cp8ppny7mzyo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Party members across di 36 states of di federation plus di Federal Capital Territory dey expected to participate for di presidential primaries wey go hold on Monday, 25 May.
Who go emerge as ADC 2027 presidential candidate?
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/cq6pplyr14vo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Speaker Ndiaye, for im resignation letter tok say di decision na "personal choice" and na for "di greater interest of di Nation"
Ndiaye and Sonko na strong allies and analysts say im resignation dey related to di sacking of di former Prime Minister
www.bbc.com/pidgin/articles/cn4ppygk4yeo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Inside one advisory wey dem issue on Monday, di army tok-tok pesin say based on credible information di insurgents dey plan to attack civilians especially for places wey dey crowded during di festive period.
www.bbc.com/pidgin/articles/cpqppdj25gyo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Nigeria President Bola Tinubu don collect im Certificate of Return on Sunday afta im win di All Progressives Congress presidential primaries.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/ce8p4zz3gz2o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Gunmen enta church wen worshippers dey do night vigil for Kwara State, kpai three worshippers and kidnap 15 odas.
Di incident happun for Ori-Oke Ajaiye, wey dey located for di outskirts of Ikiran Village, Ekiti Local Govment Area of Kwara State.
www.bbc.com/pidgin/articles/cy821j0lz4xo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Nigeria President Bola Tinubu go collect im Certificate of Return on Sunday afta im win di All Progressives Congress presidential primaries.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/ce8p4zz3gz2o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Popular Ghanaian actress Beverly Afaglo don die.
Her husband Eugene Kwadwo make di announcement ontop im Instagram account on Sunday, 24 May.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c3w239zgj7jo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Nigerians and oda nationals wey wan apply for US green cards gatz do so for dia home kontris, according to one new policy. Dis move na part of President Donald Trump administration efforts to curtail illegal immigration.
Full tori: bbc.com/pidgin/articles/cm2p8lxdjd2o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Senegalese President Bassirou Diomaye Faye don sack Prime Minister Ousmane Sonko and dissolve di nation govment afta months of tensions between di two men.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cp8prgzmegyo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Nigeria don get five presidents since di kontri return to democracy for 1999.
Almost evri leader wey wan dey elected dey get promises wey dem dey make to citizens, but dis promises still neva dey fulfilled.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c142mez7722o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Alberta go hold referendum on weda di province go remain inside Canada or if dem wan vote on dia separate, dis go be di first serious test on di kontri unity in many years.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/c242dl55p4do -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di deadly ontop schools for Oriire Local govment area don make govnor Seyi Makinde take some kain decisions since di attack happun.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/c0q23lxnnkpo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
One judgement by Justice Mohammed Garba of di Federal High Court for Abuja don nullify plenti provisions for di timetable wey di Independent National Electoral Commission bin release for di 2027 general elections for Nigeria.
Full tori: bbc.com/pidgin/articles/cjepnwegkzlo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
President Bola Tinubu don commend di National Drug Law Enforcement Agency for dismantling di methamphetamine laboratory.
NDLEA say dem seize methamphetamine and chemical materials wey dey valued at more dan 480 billion naira for international market.
www.bbc.com/pidgin/articles/c8e852z7pe8o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di All Progressives Congress don hold dia primaries on Thursday, 21 May wia some anointed aspirants emerge as govnorship candidates wey go represent di party for di 2027 general elections.
Full tori: bbc.com/pidgin/articles/cz92v08nxp7o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
On Wednesday, self-proclaimed activist, Sunday 'Igboho' Adeyemo officially launch im own security outfit wey e call 'Ija Ekun.'
Di full tori dey hia: www.bbc.com/pidgin/articles/c4g4wnemymmo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
During di kasala, six patients escape from di facility, including three wey get Ebola cases wey authorities don confam.
Dem also put fire for some parts of di Ebola treatment centre for Rwampara General Hospital.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/c626npez83eo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Temi for her IG handle today post say "Before I form you inside womb I don already know you, Bifor dem born you I set you apart".
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c5yr516k4lro -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
One court bin clear di companies for April 2023 but afta dis appeal, dem don find dem guilty.
Di Paris Appeals Court find dem guilty of corporate manslaughter for di incident.
www.bbc.com/pidgin/articles/cd6pw8770gjo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di 48 national teams wey dey involved must register squad of between 23 and 26 players, including three goalkeepers, on or bifor Tuesday, 2 June.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/cj6px3jx21ro -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di National Drug Law Enforcement Agency don bust factory wia drug pipo dey use cook illegal drug, methamphetamine, deep inside one forest for Ijebu Ode, Ogun State, southwest Nigeria.
Full tori: bbc.com/pidgin/articles/c8e852z7pe8o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Nigeria President Bola Tinubu don announce di appointment of Professor Segun Aina as di new Registrar of di Joint Admissions and Matriculation Board.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cdxp47eepkeo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Ghana authorities don postpone di evacuation of citizens from South Africa sake of xenophobic attacks afta di number of registered Ghanaians rise from 300 to 800 for di last-minute.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c4g04j02g9qo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di US don charge former Cuban leader Raúl Castro wit conspiracy to kpai US nationals and oda crimes ova di 1996 downing of two planes between Cuba and Florida.
Full tori: bbc.com/pidgin/articles/c9v3x2d3pggo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Observations by BBC News Pidgin show say na consensus arrangement be di order of di day for majority of di states, while di places wia election actually take place, na mostly aspirants wey get di endorsement of di state govnors win.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c0e2rwr4dw0o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Three hundred Ghanaians wey register for voluntary repatriation from South Africa ova harassment and xenophobia dey expected to arrive for di kontri today.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c4g04j02g9qo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Govnorship aspirants for some states don begin withdraw from di APC primaries wey go hold today.
Some of dis aspirants including River State Govnor Siminalayi Fubara say na sake of peace and unity.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cz92v08nxp7o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
For statement e sign by imsef, Govnor Fubara say e go support who ever go emerge as di candidate of di party.
www.bbc.com/pidgin/articles/cqjp2ewr4k7o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di All Progressives Congress (APC today hold dia primary elections for aspirants wey wan contest for seats into di various State House of Assembly across di kontri.
But di drama for Lagos plenty sake of Desmond Elliot, Barakat and Gbajabiamila interest.
www.bbc.com/pidgin/articles/c0e2rwr4dw0o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di way dem welcome Vladimir Putin outside di Great Hall of di People na almost di same reception dem do for Donald Trump last week.
Two ogbonge presidential visits, just days apart, na exactly di image Xi Jinping wan show di world.
www.bbc.com/pidgin/articles/cn8p2v89nyqo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Pastor Dolapo don already tender apology di supporters of Arsenal afta dem win di Premier League.
But im be and wetin we sabi about am.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/c5y7vpw5262o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Nigerian actor-turned politician Desmond Elliot don carry mata enta anoda level ontop di political drag-drag wey dey go on between am and im godfather, Femi Gbajabiamila, for Surulere constituency.
Full tori: bbc.com/pidgin/articles/cwy28pd3kpgo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di All Progressives Congress (APC), dis Wednesday, go hold dia primary elections for aspirants wey wan contest for seats into di various State House of Assembly across di kontri.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c0e2rwr4dw0o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Arsenal na 2025/2026 Premier League champions 🏆
-
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Arsenal emerge Premier League champions after Manchester City fail to beat Bournmouth before di last game of di league on Sunday.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/cgepx44j5q7o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Videos wey BBC sight show as plenty pipo dey run up and down for di city, plenty of dem na young school children and dia parents.
Voice wey dey tok for di video claim say parents dey withdraw dia pikin dem from school sake of bandits.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cvgz1z0jzj6o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Check di full Afcon 2027 qualifier fixtures as e go happun.
www.bbc.com/pidgin/articles/cqxpq1zr9z1o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
EFCC Chairman Ola Olukoyede tell tori pipo say dem arrest former minister of Power Mamman for early mor-mor of today for Kaduna.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/c707975d1glo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Kontris don begin name dia squads for di 2026 World Cup as dem dey prepare for dis summer tournament, wit England and Scotland set to follow.
Thomas Tuchel go name im England squad on Friday afta Steve Clarke don release Scotland own on Tuesday May 19.
www.bbc.com/pidgin/articles/cj6px3jx21ro -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Senator Ipalibo Harry-Banigo, wey be Nyesom Wike deputy govnor dey currently represent Rivers West senatorial district, but di All Progressives Congress no clear am to contest.
She don react to di mata as she call on President Bola Tinubu to intervene.
www.bbc.com/pidgin/articles/c0q2542lg27o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Some aspirants chop defeat from dia opponents for di All Progressives Congress Senate primaries wey happun yesterday, while di party no clear some pipo.
So wat next for dem? Di answer dey here: www.bbc.com/pidgin/articles/c2426g54z7jo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Two teenage attackers shoot and kpai three men for one mosque for San Diego California for suspected hate crime bifor dem take dia lives, according to police.
Di shooting bin happun for Monday morning.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c5yr22vvqkvo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Despite say di Food and Drugs Authority for Ghana bin ban di import and sale of turkey tail for 1999, you go find am for city centres, bus stations, markets and oda places.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cgrp1125q4no -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Among di big losers of di APC Senate primaries ticket na Senator Ned Nwoko wey dey represent Delta North Senatorial District. E lose to former Delta State govnor Ifeanyi Okowa by a wide margin.
Full tori: bbc.com/pidgin/articles/cd6pxyv8g5yo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
While president Tinubu don assure say dem go release di victims, schoolteachers for Oyo State dey protest and di govnor Seyi Makinde don order say make dem close some schoolsv for di state.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/ce3pzwz9vzlo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Before di war, Ukraine dey popular as di second biggest place for commercial surrogacy after United States.
Even though di war don shake di surrogacy matter, dem don almost come back to di level wey e be before di war, na so experts tell BBC World Service
www.bbc.com/pidgin/articles/c8r8vg7z4e2o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Tori be say do kidnappers behead oga Michael Oyedokun, one of di abducted teachers of Community High School, Ahoro-Esinele Oyo state but BBC neva confam how e happun.
www.bbc.com/pidgin/articles/ce3pzwz9vzlo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Several serving govnors wey dia tenure go soon end and former govnors dey among di aspirants wey dey chook head for di Senate primary elections of di ruling All Progressives Congress wey dey happun today.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cd6pxyv8g5yo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Nigeria ruling All Progressives Congress on Saturday 16 May, hold dia primary elections for aspirants wey wan contest for di House of Representatives, and di exercise across di various states for di kontri throw up ogbonge surprises.
Full tori: bbc.com/pidgin/articles/cvgzdgv82dko -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di World Health Organization (WHO) don declare Ebola outbreak for di Democratic Republic of Congo as public health emergency of international concern.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c5y9pkqxzv1o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Kenya transport sector don begin nationwide strike sake of di rising fuel prices as operators across di industry decide to suspend services all ova di kontri.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c0q2pj715p8o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Ror series of post on im Instagram story today Cubana Chief Priest clear am say, im no even take part for di primary election, as e say im voluntarily withdraw from di race afta di state govnor, Hope Uzodimma follow am tok.
www.bbc.com/pidgin/articles/c8r8vr77jz6o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di global health body warn say wetin dey happun "big pass outbreak" and currently e pass wetin dem dey report, wit significant risk of local and regional spread.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/c5y9pkqxzv1o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Although arms import don drop by -41 % for Africa, according to di report by di SIPRI, Sub-Saharan Africa remain active region in di arms race.
For kontris like Nigeria, wia dem dey buy dia arms from?
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c0q2l9zp19qo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Among di new measures wey dem dey tok about pass na di one wey say any player wey deliberately cover im mouth during any confrontation wit im opponent go collect red card.
www.bbc.com/pidgin/articles/cgrpq244e24o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Pascal Okechukwu alias Cubana Chief Priest run under di platform APC but e fail to secure di party ticket to contest for di election.
Di primary election for di House of Representatives hold today and na part of preparation for di 2027 general elections.
www.bbc.com/pidgin/articles/c8r8vr77jz6o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Popular streamer, Carter Efe say di controversy wey e find imsef nearly lead am to depression
E tok to BBC News Pidgin for interview
@carterefe__ also reveal who im go fight next and im relationship wit Wizkid for di music industry
Producer: @oloyenaija1
Edit: @mobolajiOlatun2This media couldn't be displayed. See it on the original post. -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Parents of di schoolchildren wey give update on di attack on Saturday, 16 May, tok say most of di victims na children from di nursery section of di Schools wey dem believe say dey between two and five years old.
Read full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c4g8992d71go -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Kontris don begin name dia squads for di 2026 World Cup as dem dey prepare for dis summer tournament.
Di 48 national teams wey dey involved must register squad of between 23 and 26 players, including three goalkeepers, on or before Tuesday June 2.
www.bbc.com/pidgin/articles/cj6px3jx21ro -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Many pipo, especially di Igbos for southeastern Nigeria dey use am mainly as a soup thickener for dia native soups, but e pass like dat.
Full tor: www.bbc.com/pidgin/articles/cdjplyxg48vo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Wetin bin make Mahmoud Sadis Buba go viral na sake of im small stature and controversy ova im age.
Allegations dey say e fake im age, say e no reach di age wey e dey claim but Sadis say im no be small pikin.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/cy520d26k9po -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Nigerian military neva tok anytin about di raid but if dem confam am, di death of di ISIS oga fit affect di operations of di Islamic State group (IS) since di killing of dia leader Abu Bakr al‑Baghdadi for 2019.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/c78knygj8emo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Gunmen attack primary and secondary schools for Oyo and Borno states on di same day and abduct unspecified number of students.
Dem kidnap students for Oyo and Borno schools and kpai on teacher for di southwestern state.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c4g8992d71go -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Gunmen on Friday attack LA School and Community Grammar School, Ahoro-Esinele, for Ogbomoso, Oyo State, southwest Nigeria.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c4g8992d71go -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Nigeria anti-corruption joinbodi, di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC), don carry social media influencer, Blessing CEO go court for two count charges of rent fraud wey reach ₦36 million.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/crkpj6xe070o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Mahmoud Sadis Buba tok say e take im small body size resemble im grandpapa and say im stature no go affect im ability to serve for National Assembly.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/cx21ny4g0n0o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Police say one victim bin file formal complaint wey allege say some armed policemen wey pose as stop-and-search officers unlawfully abduct and rob am along Igbo Etche Road for Port Harcourt.
Read full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c5ye8rdg2e5o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
According to di allegations inside di indictment, di three pipo target older Americans on top dating websites and social media wey dem engage for romance and fraud schemes, from July 2024 to April 2026.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cy42rvm9jdgo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Ebola virus na serious disease wey fit kill pesin.
E dey spread through direct contact wit di body fluids of pipo wey get am, contaminated materials or pesin wey don die from di disease.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/c5y75v1mdj1o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Good morning!
How you see dis proverb from Dabi Rah?
Reason am and share your own for comment -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Police don arrest di woman on top allegation say she set her co-wife, Firdausi Musa, and her five- and three-year-old children on fire.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/cj4pwgjj5l0o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Four major political parties for Nigeria don drop timetable for wen dem dey plan to run dia own primaries ahead of di general elections for 2027.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cr5p68gq4l7o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Wit Arsenal sitting on top of di league table e no be surprise say na dia players dominate di least wit three out of di eight nominees for di ogbonge award.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/cp3p7ppjypyo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Kwara State High Court for Ilorin don convict and sentence Prophet Ajiboye Olayinka to life Imprisonment sake of say im bin get unlawful sexual intercourse wit three minor congregants.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cj0pygrgj9zo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di judge order all security agencies, plus international police (Interpol) to arrest Mamman anywia wey dem see am.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cn9p2qp9yv1o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Dis na di first time oga Ramaphosa go face di lawmakers since one court for di kontri rule say dem suppose set up process to determine weda to impeach di president.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/c936dwvn1qwo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
For December 2025, di federal govment bin label kidnappers, bandits and oda armed groups as terrorists wey put dem for inside di Nigeria counter-terrorism work.#
Di full analysis: www.bbc.com/pidgin/articles/c5yxpe8g41eo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
South Africa don release di list of ova 100 untraceable suppliers wey dey operate for di kontri by deceiving customers wey dey patronise dem.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cvgznpzx319o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di family of Nigerian actor Alexx Ekubo don reveal wetin kpai di actor and wia e die as dem formally announce im passing on Wednesday 13 May.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cp9p4y70dlyo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Federal High Court for Abuja Nigeria don sentence di kontri former minister of power Saleh Mamman go 75 years imprisonment sake of corruption and fraud.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c707xk3gdp4o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Remember say Inec bin don announce for di 2027 election timetable wey dem bin release, say di window for parties to hold dia primary election na betwin April 23 and May 30, 2026.
Read full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cwy2e9l3ej8o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Veekee James bin announce di pregnancy for February dis year wia she bin reveal say dem bin dey try get di belle for one year.
Actors Stan Nze, Shaffy Bello and odas don begin congatulate di couple.
www.bbc.com/pidgin/articles/cm2pvmv7mp7o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
If di American president and im administration wan see di kain future wey Beijing don dey pursue for di last ten years, e get wetin dem gatz do.
Full tori dey hia: www.bbc.com/pidgin/articles/c809drj0z83o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Clerk to Ghana parliament Ebenezer Djietror inside one statement confam di arrest of Kwame Ohene Frimpong for one airport for Netherlands, and add say dem dey work to get more details about di MP arrest.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/cwy25lvpx2jo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
'Rest on Alex' don dey trend for social media as tori of di death of di Nollywood star begin spread.
Im family, management or guild of editors neva tok anytin – tributes don already begin pour in from im colleagues for di Nigerian movie industry.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/cyv2j10nnrqo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di 63-year-old na di clear favourite - and currently di only candidate Real Madrid dey tok wit ova di role.
Mourinho go replace current head coach Alvaro Arbeloa, wey take charge for January afta Xabi Alonso comot.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/cn8p62yz2neo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di report add say Nigeria make up five percent of all students wey dey japa for di world.
Di full report dey hia: www.bbc.com/pidgin/articles/c1e209nd7v3o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Why UK Prime Minister Keir Starmer dey under pressure to resign?
www.bbc.com/pidgin/articles/cvgz1vxjv4eo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Ghana begin process to repatriate over 200 citizens from South Africa as some locals seize keys from foreign shop owners
www.bbc.com/pidgin/articles/clyp2gp7lk1o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
South Africa President Cyril Ramaphosa for one short notice address to di nation on Monday say im don dey face calls to resign from im position sake of di ruling.
Read: www.bbc.com/pidgin/articles/c4g4kz94gwdo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di difference between dis role and dat of di Office of di National Security Adviser (NSA) neva clear.
But di appointment dey come for time wey Nigeria dey face security challenges from bandit attacks to terrorists bombing.
www.bbc.com/pidgin/articles/c775vl76x2no -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
For di policy, jamb also set di age wey candidates fit enta Nigeria tertiary instituions.
Dem add say candidates wey dey find admission for agriculture programs too no go need do UTME wen dem apply for di admission.
www.bbc.com/pidgin/articles/clypznnjmdvo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
APC don screen Rivers State Govnor Siminalayi Fubara, but e go get di ticket to contest?
www.bbc.com/pidgin/articles/cddp21pp3jzo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
South Africa declare state of disaster afta days of serious bad weather
www.bbc.com/pidgin/articles/c8e86zj66glo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
More dan 100 pipo don fall sick for one cruise ship wey dey come from Fort Lauderdale, Florida, wit highly contagious norovirus during dia two-week trip.
www.bbc.com/pidgin/articles/cn0p5zw7lg3o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Mohammed Ismail Sherif wey im stage name be Black Sherif aka Blacko don win Ghana Music Awards artiste of di Year for 2026.
Dis be afta im beat five odas for di tense awards show wey happun for di Accra International Conference Centre on Saturday.
www.bbc.com/pidgin/articles/cy42vn5w229o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
African stars bin dress for di Africa Magic Viewers’ Choice Awards, but beyond di fashion moments na unforgettable wins wey light up di night.
Dis na di looks and standout moments evribodi still dey tok about: bbc.com/pidgin/articles/c78q7j07d7yo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Linda Ejiofor win di Best Lead Actress and Best Supporting Actress for AMVCA 2026.
Uzor Arukwe win di Best Lead Actor, while Bucci Franklin win di Best Supporting Actor.
See full list of winners: bbc.com/pidgin/articles/ce8p44ldp77o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
NDC hold dia national convention afta Kwankwaso, Peter Obi join di party
www.bbc.com/pidgin/articles/c9q3w97d53lo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
AMVCA 2026: Time, nominees and oda tins to know
www.bbc.com/pidgin/articles/ce8p44ldp77o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Black Sherif, Stonebwoy, Wendy Shay and odas wey fit win Ghana music awards artiste for 2026
www.bbc.com/pidgin/articles/cy42vn5w229o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
South Africa govment don begin review dia immigration policy to address di mata of illegal migration plus allegations of xenophobic attacks on black foreigners.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cp8pyz680pqo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di removal of end to end encryption (E2EE) for messages na major U-turn by parent company Meta wey previously championed di tech as di gold standard for user privacy.
www.bbc.com/pidgin/articles/c5y7p6yej83o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Hisba Command for Azare, Katagum Local Govment Area of Bauchi State, tok say dem don arrest and detain seven men wey dem suspect say dem dey exchange dia wives among demsefs.
www.bbc.com/pidgin/articles/ce3pvl19729o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
South African opposition leader Julius Malema don call on President Cyril Ramaphosa to resign.
Dis dey come afta di Constitutional Court rule say parliament violate di constitution as dem block moves to impeach am for 2022.
www.bbc.com/pidgin/articles/c87qp1z7z89o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Sowore para for court, accuse judge of bias afta e reject im 'no case submission'
www.bbc.com/pidgin/articles/cvgzn11y98go -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di US State Department tok say dem go begin revoke di passports of Americans wey owe big amount of money for child support.
Bifor, na wen pipo wey owe plenty debt and wan renew dia passports dem dey face di consequences.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cqxp402q30ro -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
World Cup 2026 song wit Shakira and Burna Boy - Wetin to know
www.bbc.com/pidgin/articles/clyp52r2lg2o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
'I pray for one child, I get five' - Woman born quintuplets naturally afta 12 years of trying
www.bbc.com/pidgin/articles/crkpx02dekgo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
One Federal High Court for Abuja, Nigeria capital, don convict one former Minister of Power, Saleh Mamman of money laundering of about 33.8billion naira and fraud.
Di judgement dey come days afta di ex-minister pick form to run for govnorship election.
www.bbc.com/pidgin/articles/cn7pv81yr1ko -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Four doctors and three nurses sanctioned for medical negligence ova death of hit-and-run accident victim for Ghana
www.bbc.com/pidgin/articles/c74rk3k1yzjo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Ghana petition Africa Union to chook mouth for 'xenophobic attacks' against African migrants for South Africa
www.bbc.com/pidgin/articles/cp8pyz680pqo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Wetin be di changes for Senate rule book wey cause gbas-gbos betwin Akpabio and Oshiomhole?
www.bbc.com/pidgin/articles/ckgpnxmkzw4o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
PSG go now meet Arsenal for di final of di Champions League on 30 May afta dem play 1-1 draw with Bayern Munich.
Na Ousmane Dembele score for PSG while Harry Kane score for Bayern Munich.
Di semi-final end on 6-5 aggregate.
www.bbc.com/pidgin/articles/cn5p2wz12e5o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Peter Odike wey marry South African woman tok how dem dey bully im children for school and how foreigners wit legal status for di kontri don begin fear for dia lives as di protests dey continue.
Full tori: bbc.com/pidgin/articles/c9weprlnqddo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
First half don finish and na still one goal dey for di match.
Wetin be your prediction?
Live text commentary dey here: www.bbc.com/pidgin/articles/cn5p2wz12e5o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Ousmane Dembele of Paris Saint Germain say make Bayern Munich use one goal hold body as di match start.
Bayern Munich go fit equalise?
Follow live text commentary for here: www.bbc.com/pidgin/articles/cn5p2wz12e5o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Match don start!
Who dey sing di song of victory dis night to go face Arsenal on 30 May?
Follow live text commentary for here: www.bbc.com/pidgin/articles/cn5p2wz12e5o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Media mogul Ted Turner, wey bin pioneer di modern 24-hour news culture wen e launch di CNN channel, don die at di age of 87.
CNN announce im death on Wednesday 6 May.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cp8pvnn21p3o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
As Arsenal beat Atletico Madrid to reach dia first Uefa Champions League final for 20 years, fans go turn dia focus to Germany.
Bayern Munich dey host defending champions PSG for di Allianz Arena.
Who go face Arsenal for di final?
www.bbc.com/pidgin/articles/cn5p2wz12e5o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Nigeria move up for latest Henley Passport Index ranking - Top passports in 2026
www.bbc.com/pidgin/articles/cvgz1w1jwq0o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Ghana authorities relocate citizen wey face harassment for South Africa, prepare to remove odas as anti-immigration protest continue
www.bbc.com/pidgin/articles/c2k2gjxy4v2o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Afta 20 years of trying, Arsenal don finally make am to di Champions League final afta dem sama Atletico Madrid 1-0 for Emirates Stadium.
Saka come through for Arsenal for di 44th minute.
One step closer - Arsenal go lift di trophy? bbc.com/pidgin/articles/ckgpy99wv9xo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Time don reach for di ogbonge Arsenal vs Atletico Madrid Champions League semi-final.
Follow live text commentary here: www.bbc.com/pidgin/articles/ckgpy99wv9xo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
All eyes go dey di Emirates stadium for London on Tuesday as Arsenal host Atletico Madrid for di second leg of di Uefa Champions League.
Di first leg between di two teams for di Wanda Metropolitano bin end 1-1 last week.
Who go reach di final? www.bbc.com/pidgin/articles/ckgpy99wv9xo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
For dis tori, we look di times Peter Obi, Rabiu Kwankwaso and Atiku Abubakar don change parties since di kontri return to democracy for 1999.
www.bbc.com/pidgin/articles/cze2pwe44z6o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
How Arsenal, Manchester City fit win 2025/2026 Premier League
www.bbc.com/pidgin/articles/cpdpx936n0go -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Met Gala 2026: Beyonce, Heidi Klum, Katy Perry plus oda most talked about looks dis year
www.bbc.com/pidgin/articles/c8937ee3x22o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Nigerian political parties don begin make plans to participate for di 2027 general elections as di major ones don release dia timetables.
As timetables dey come out, alliances, defections, and political calculations dey happun among politicians.
www.bbc.com/pidgin/articles/cr5p68gq4l7o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
About 150 Nigerians wey dey live for South Africa don show interest to comot di southern African kontri as anti-immigrant marches continue for some cities for di kontri.
Di anti-foreigners campaigners say dem want make foreigners comot dia kontri.
www.bbc.com/pidgin/articles/c809v0dnylgo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
United States Department of Homeland Security tok say dem arrest one Nigerian man, Chidozie Wilson Okeke, ova im alleged previous criminal record of "assault and illegal drugs possession."
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c8e8w0rnn2do -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Kingsley Akunemeihe share post for im X handle wey bin claim say Tony Elumelu don divorce in wife, Awele.
www.bbc.com/pidgin/articles/cm2plmlgn97o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
NDC na better opposition for Peter Obi, e go fit win wit dem for 2027?
www.bbc.com/pidgin/articles/cp8p3d363l4o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Wetin be hantavirus wey dem confirm on one Atlantic cruise ship?
www.bbc.com/pidgin/articles/clypnq3nlygo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di former govnor of Anambra State Peter Obi and di ex-govnor of Kano State Rabiu Kwankwaso don join di Nigeria Democratic Congress (NDC).
www.bbc.com/pidgin/articles/c2k2xpz4ydxo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Nigerian govment say dem dey make arrangements to voluntarily bring back citizens wey dey live for South Africa sake of say xenophobic attack for dia fit escalate.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cn0pxy78z0yo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Major political parties for Nigeria don dey prepare for di 2027 general elections as dem don fix dates for primaries.
www.bbc.com/pidgin/articles/cr5p68gq4l7o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Na di same mama born Michelle and Lavinia just minutes apart but dem get different papa.
Science don explain wetin be di reason for di case of di 49-year-old twins.
www.bbc.com/pidgin/articles/c9d3pe42pvzo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di govment say dem go formally convey dia concern for one meeting on Monday, ova di incidents for South Africa wey fit affect existing relations between both kontris.
www.bbc.com/pidgin/articles/cn0pxy78z0yo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
During sexual activity, di brain dey produce endorphins, wey be natural neurotransmitters wey dey create feelings of excitement, satisfaction, and happiness.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/ckgp764rpk9o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di public prosecutor of one military court for Mali capital Bamako say one group of sojas don chop arrest in connection wit di recent large-scale coordinated attacks by jihadists and separatists for di kontri.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cwy2120z2dno -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Content creator and streamer Carter Efe sama Nigerian singer Portable wetin no good for ring during dia celebrity boxing match wey happun on Friday 1 May.
But why celebrity boxing dey gain ground for Nigeria? E dey inside dis tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c0l2pj3w9gko -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Federal jury for di United States find two men and a woman guilty of international email hacking scheme wey don defraud ova 1,000 victims of 215 million dollar.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cp8p1yn83gro -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Nigerians on and off social media wey watch di horrific video of di extra-judicial killing of 28-year-old Mene Ogidi dey ask series of questions wey di Nigeria Police Force fit provide answers to.
www.bbc.com/pidgin/articles/czd255r279no -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Why UK lift threat level from 'substantial' to 'severe' for di first time in four years
www.bbc.com/pidgin/articles/cgqpy11vy92o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Nollywood actor Lateef Adedimeji and wife Mo Bimpe welcome triplets five years after marriage
www.bbc.com/pidgin/articles/c8r8ll3mgryo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
China cancel tariffs for all African countries except one - Wetin e mean
www.bbc.com/pidgin/articles/ckgp0n6x1n3o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Supreme Court of Nigeria don uphold Court of Appeal directive wey say make di Independent National Electoral Commission (Inec) maintain status quo for ADC leadership wahala.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cgmpge8l3jdocgmpge8l3jdo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Central Bank of Nigeria (CBN) don introduce stricter BVN enrolment and data access rules wey go take effect from 1 May.
Dis latest update from CBN Payments System Policy Department go affect all banks and oda financial institutions.
www.bbc.com/pidgin/articles/cjwpd1n7503o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Supreme Court for Nigeria on Thursday uphold Court of Appeal decision wey nullify PDP convention for Ibadan.
Three out of di five-man panel of judges bin give di ruling to nullify di convention, while two odas say di appeal get merit.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/clyp5q23q39o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Oil price hit highest since 2022. Fuel price go increase again?
www.bbc.com/pidgin/articles/cpvp21rpnnwo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Supreme Court to rule on leadership crisis between ADC and PDP
www.bbc.com/pidgin/articles/clyp5q23q39o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Nigerian police say dem don dismiss di officers wey dey involved for di killing of Mene Ogidi for Effurun, Delta State.
Dem give dis update on Wednesday wia dem identify di officer wey use gun end di guy life as ASP Nuhu Usman.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c8xwlzqrz2lo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di Nigerian govment don ask South African govment to protect Nigerians and oda black immigrants wey dey live for South Africa sake of di rise in xenophobic protests.
www.bbc.com/pidgin/articles/c052j5qvnr2o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di EFCC chairman Ola Olukoyede say di agency bin observe say one domiciliary account dey wia dollars and pounds bin dey "drop like raindrops" from Colombia, America, Sri Lanka, and Togo.
E say dat na wen im begin investigate Pastor Jerry Eze.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/ce3pzzlpnvro -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Robert Mugabe son to dey deported to Zimbabwe afta e plead guilty to firearm offences
www.bbc.com/pidgin/articles/cgjpvjxn61eo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
'We no dey legally married na introduction we do' - Olakunle Churhill react to controversy wit Rosy Meurer
www.bbc.com/pidgin/articles/cvgz4g11zmeo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Outrage as police officer 'execute' man for public inside viral video
www.bbc.com/pidgin/articles/c8xwlzqrz2lo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Coordinated attacks for Mali ova di weekend kpai Defence Minister Sadio Camara and recapture territory for di north.
Di military come into power to improve security, but di weekend attacks don bring dat into question.
www.bbc.com/pidgin/articles/c794wxln37xo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di management of di National Youth Service Corps say dem dey work wit relevant security agencies to find out di full story around di death of 24-year-old Abdulsamad Jamiu.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/cgqkq51j8p3o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
"Di suspects chop accuse of numerous crimes. Dis include romance scams and oda cyberfraud offences wey cause millions of Swiss francs in damages, as well as money laundering," Europol tok inside one statement.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/czd2pjd692yo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Who be Obafemi Hamzat wey Sanwo-Olu 'anoint' to be next Lagos State govnor
www.bbc.com/pidgin/articles/c93x5knd9p0o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Anti-migrants demonstration start for South Africa as recent attacks lead to death of two Nigerians
www.bbc.com/pidgin/articles/c9d31q0y0jjo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
IS claim responsibility for Adamawa attack wey kill 29 pipo
www.bbc.com/pidgin/articles/cdxplgy7r7eo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
One woman bin carry im two-year-old twins go do DNA test, and she realise say na two different men she born di children for.
Di result shock di lab sotey dem do am again to make sure. Di twins get di same mama, but na two men born dem.
www.bbc.com/pidgin/articles/cj3736ke164o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di family of 24-year-old corps member, Abdulsamad Jamiu, don debunk di Nigerian Army account of how e take die for dia family residence for Shagari Quarters, Dei-Dei, Abuja, claiming say na false and misleading account from di Nigeria Army.
www.bbc.com/pidgin/articles/cgqkq51j8p3o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
President Cyril Ramaphosa of South Africa don address di recent xenophobic attacks for im kontri against fellow Africans.
www.bbc.com/pidgin/articles/cr5150vpn1go -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Ghanaians lament power crisis, black out wey dey affect pipo and businesses
www.bbc.com/pidgin/articles/cvg0gjezvxeo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Suspected gunman for White House Correspondents dinner na 31-year-old man wey be wan 'shoot Trump administration officials'
www.bbc.com/pidgin/articles/cm2r2p94g29o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Gunman fire shots for White House Correspondents Dinner wey Trump and wife bin dey attend
www.bbc.com/pidgin/articles/cn535wrxyr7o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Explosions and gunfire go off for major military base in Mali - wetin we know
www.bbc.com/pidgin/articles/c05d3015p1po -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Wetin I learn afta I stop sugar for six weeks
www.bbc.com/pidgin/articles/c1d9wq9r55po -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Scientists uncover lasting damage for children brains - na malaria get di blame?
www.bbc.com/pidgin/articles/clyxdw9qyv4o -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Nigeria don issue fresh warning to dia citizens wey dey live for South Africa afta tori of renewed anti-foreigner protests for some parts of di kontri.
Full tori: www.bbc.com/pidgin/articles/c98kx35dg2eo -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Di BBC don reveal dia list of 100 inspiring and influential women from around di world for 2024.
www.bbc.com/pidgin/resources/idt-4f79d09b-655a-42f8-82b4-… -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
Wetin be di Special Anti-Robbery Squad? - From wen dem form di Nigeria Police unit for 1992 till today and wetin don change plus why pipo dey ginger say make SARS end, we get dis full video.
#endsars #sarsmustend #endsarsprotestsThis media couldn't be displayed. See it on the original post. -
BBC News Pidgin
@bbcnewspidgin
"My bizness na to turn pure water leather into inter locking tile"
Intissar story for Abuja go ginger you to tink. Read more www.bbcpidgin.comThis media couldn't be displayed. See it on the original post.
































































































































































































































































































































































































































































































































































